Both players and fans of Rivers United feel double-minded inside the Adokiye Amiesimaka Stadium on Sunday evening as rain dey fall, as dem play Katsina United for the final game of the 2025/26 Nigeria Premier Football League (NPFL) season.

Rain-soaked fans cheering Rivers United at the stadium during the NPFL season finale

The Port Harcourt team need to win by all means to get any chance to carry the NPFL trophy. But dem dey look up to Enugu Rangers make dem lose points against Ikorodu City for Lagos, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Rivers United Do Dem Own Part For The NPFL Title Race

But e no favor Finidi George boys as match for another stadium change the matter. Even though the Pride of Rivers play beta ball to collect all the three points, Ikorodu City no fit stop the Flying Antelopes, wey dem sef ready to carry the cup.

Rivers United beat Katsina United 3-0

Rivers United wire Katsina United 3-0 clean sheet, dem score one goal for first half before dem add two more after half-time.

The win sweet the belle of the home fans wey pack full stadium dey hope say dem go see history happen.

  NPFL: Enugu Rangers still dey hot like Cameroon pepper as Rivers United and Shooting Stars no gree too

But Enugu Rangers go win 2-1 for Lagos to sharp-ally carry the NPFL cup.

Just 19 minutes into the match, Rivers United score first goal through Chijioke Mbaoma, wey gently play penalty enter net after Katsina United defender touch ball with hand inside box.

Rivers United players celebrating a goal during the NPFL season finale

The home team hold dem one-zero advantage go break, even though the weather bad small.

Chijioke Mbaoma Two Goals No Reach as Rivers Manage Collect CAF Champions League Ticket

As second half start, heavy rain still dey fall, but the Garden City boys face dem work.

Rivers United 3-0 Katsina United

For the 63rd minute, Okon Aniekeme nack one heavy jankara shot from the edge of the box to make the goal two.

Just four minutes after, Mbaoma score again to complete his two goals, make the match 3-0, and stadium scatter with celebration.

As Rivers United fans dey jubilate say dem don win cup, Rangers sef dey do dem own level for Lagos.

Chidiebere Nwobodo score two goals, one for first half and another one for second half, to put the Coal City team for front.

  CAFCL: Rivers United kolo after Pyramids run dem street for Uyo

Ali Moses score one for Ikorodu City to reduce the gap, but Rangers hold dem ground win the match, take one point pass Rivers United to carry the NPFL title.

As the long season don end, Rivers United go just manage final position wey go carry dem go next season CAF Champions League.

Katsina United team vs Rivers United

If dem look back at how the season waka, the Port Harcourt team go dey regret the four consecutive away match wey dem lose back-to-back, na those results cut dem throat for this title race.

Finidi George Talk Him Mind

After the match, the head coach Finidi George talk about how the season waka during his press conference.

“E really pain me. I think we give everything today. But to win league no put head for last match. I think na those bad results wey we get before na im cause am. For this last day, we dey wait make Ikorodu win. That one no be the best way to win league.

But the players try dem best. We just have to congratulate Rangers for the beta run wey dem get. We think say dem go loose guard for Bayelsa, but dem win there.

Finidi George watching from the sidelines during the NPFL season finale

And today again, we dey think say at least Ikorodu go give dem tight fight. Even if na draw, we for carry the cup.

But e no happen like that. So we must to move on. I know say e dey pain the boys,” Finidi talk.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 24, 2026 9:56 pm by Hitvibz Media