When last you see don football team wey dem spray millions of money, come dash dem brand-new bus untop? Nasarawa Amazons don run am again, as Governor Abdullahi A. Sule open im pocket, dash dem ₦85 million plus one correct Toyota Hiace.

Amazons ladies don kuku receive cash reward from Nasarawa state Governor

Governor Sule dash Nasarawa Amazons ₦85 million

Nasarawa Amazons pack ₦30 million straight — ₦25 million enter players hand direct, while ₦5 million na for coaching crew, na weytin Hitvibz report be dat.

Dis money na part of big ₦85 million wey di governor reserve for athletes, coaches and people wey make di state proud.

  “2-0 Na Nuttin” – Rivers Angels Baller Sandra John Yan Wetin Coach Blankson Talk Before Dem Win FA Cup

Nasarawa Amazons don kuku receive cash reward from Governor Sule

No be only money, Governor Sule still give Amazons brand-new Toyota Hiace bus join.

Dis one show say im government dey serious to grow sport for Nasarawa State.

Nasarawa Amazons dey shine for field and outside

Governor Sule don go gift new bus to Nasarawa Amazons

Make you remember say di Lafia babes finish di regular Women’s Premier League season for second position and carry silver medal for di 25th Women’s President Federation Cup for Lagos.

Di club still produce two Most Valuable Players — Akekoromowei Janet for NWFL and Shobowale Olushola for President Federation Cup.

  Falconets World Cup Call-Up: Edo Queens, Bayelsa, Nasarawa Carry Big Share for List

Dis back-to-back success na why di governor dey always stand gidigba behind di team.

Nasarawa Amazons dey celebrate Governor Sule’s support

Im government don talk am clear say to support sport teams like di Amazons go help put Nasarawa State name for big map.

You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 5, 2025 12:33 pm by Hitvibz Media