e young, e no dey fear, and e ready for Premier League — na wetin Chelsea manager Enzo Maresca see for Estevao Willian body afta dem win Palmeiras for FIFA Club World Cup.
For Friday night, Estevao make Chelsea fans happy as e knack better goal against di team wey e go join later while e still dey play for Palmeiras, na wetin Hitvibz report be dat.
Estevao Willian show Chelsea say e ready for big stage
Willian, wey just be 18, no fear for dat Club World Cup match. From when ref blow whistle, e show say e dey serious for Palmeiras — e dey enter tackle, dey fight for every ball.
Na so, just eight minutes for second half, Estevao remind everybody why di 2025 Conference League winners gree drop £29 million for am.
E collect sharp pass for box, use him left leg control, waka pass Levi Colwill, then fire one rocket shot wey bounce bar enter net wey Robert Sanchez no fit stop.
Him goal balance di match 1-1 afta Cole Palmer don first score for EPL team. Last last, na Maresca team win 2-1 because of one late own goal by Agustin Giay, but na Estevao moment turn everybody head.
Chelsea’s Maresca sure say Estevao fit handle Premier League wahala
Afta final whistle, oga Enzo Maresca no hide him joy say Estevao go land for Stamford Bridge dis month.
When dem ask am if di Brazilian fit survive di Premier League wahala, Maresca talk say:
“Yes. E good well well. You fit see say e be big talent. You fit see say e be beta player. Di only tin be say, if you dey come from South America or another place come Europe, you gatz adapt.”
Di Chelsea oga still talk say:
“So, we go help am adapt. First, make e happy, make e dey enjoy ball. And we no get any doubt because e too good, e go be very important player for Chelsea.”
Chelsea don sign Estevao since last summer but dem gatz wait make e reach 18 for April.
At 18 years and 71 days, e be di second youngest player wey score for dis year Club World Cup, na only Porto’s Rodrigo Mora younger pass am for 18 years and 49 days when e score against Al Ahly.
Now, di Brazilian star wey don get five senior caps dey come London, and Maresca sure say fans go soon see why di boy worth every kobo.
You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 5, 2025 12:21 pm by Hitvibz Media




Be the first to comment on "Chelsea oga hail surprise baller afta Palmeiras win: ‘big talent, beta player’"