Naija forward Collins Sor turn superstar Thursday night as e ginger KRC Genk give Lech Poznań heavy beating for Europa League playoff first leg.
The 25-year-old baller play 70 minutes, but e still deliver hot assist for the fourth goal as Genk knack the Polish side 5-1 for their own backyard, Enea Stadion. Na real home-wrecking tins, na weytin hitvibz dey yan be dat.
No be Sor alone carry Naija flag that night o. Him Super Eagles padi, Tolu Arokodare, enter late for last 12 minutes. Even though e no get enough time, Naija dey everywhere for the pitch.
Sor no just stop for assist. Baba still create four chances wey scatter the defence. Na why him shine pass everybody.
Collins Sor Help Genk Collapse Lech Poznań Fortress
Lech fans go need panadol after this one. Their so-called fortress fall yakata as Genk run riot with speed and precision wey dey like express train.
From kickoff, Genk hold remote control. Just 10 minutes, Patrik Hrošovský open scoring after Jarne Steuckers thread needle pass.
Lech small hope come at 19th minute as Filip Jagiełło equalise. Stadium ginger small. But na false hope, my people.
Six minutes later, Hrošovský score again. Steuckers again na the supplier. Before Lech fit breathe, Bryan Heynen slot calm finish after Matte Smets tear defence open. 3-1, wahala don dey too much.
Lech misery no stop there. Hyun-Gyu Oh win penalty, before we go drink juice drop cup, my guy man don throwey am.
But oh boy, just few minutes later, Hyun-Gyu redeem himself. Who supply am? Collins Sor. Baba serve hot assist, Hyun-Gyu just slot am. 4-1.
Second half never settle finish, when Michał Gurgul use own leg put ball for im net. 5-1. Na total disgrace.
Genk Already Dey Smell Europa Group Stage
As e be now, the tie don almost finish before second leg sef. Genk dey one step away from Europa League proper. Only miracle fit save Lech next week for Cegeka Arena.
Coach even use style rest players. Noah Adedeji-Sternberg and Arokodare enter late, but scoreline no change.
For Sor, na night of glory. Naija boy wey carry magic touch, burst Polish defence like Agege bread. Fans go dey shout say, “Super Eagles coach, abeg open eye, this guy dey ball!”
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 22, 2025 1:38 pm by Hitvibz Media



Stay connected