Weytin happen for Istanbul be say e suppose be normal clearance for amateur play-off final. Instead, e turn emotional moment wey show Gani Catan kindness and Yurdum Spor heartbreak for one unforgettable afternoon.
The wahala happen for 22nd minute of the Istanbul First Amateur League playoff final between Mevlanakapi Guzelhisar and Istanbul Yurdum Spor for Zeytinburnu, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Gani Catan Revives Seagull in Dramatic Istanbul Playoff Final
One clearance from penalty area hit seagull bird wey dey fly low for air. Na so the bird kuku faint, come fall enter pitch after goalkeeper Muhammet Uyanik kick the ball go hit am.
As players shock, na so Gani Catan run go help.
The seagull no dey breathe.
Even as em no get any medical training, the 32-year-old accountant kneel down start dey give di bird chest compressions, dey do CPR for front of shocked teammates and spectators.
For nearly two minutes, the mini-pitch just keep quiet. Then small small hope come show
Im legs start dey move small.
Im come open em eyes small join.
Na so Catan take give the bird water before he carefully carry am comot from pitch go give medical staff.
“Our captain, Catan, use CPR take revive the seagull for pitch,” Yurdum Spor write for Instagram.
The video wey sports reporter Onur Ozsoy capture spread online fast. E show Catan dey perform CPR on the bird, em teammates come surround am, before he carry am gently go sideline.
Yurdumspor Lose Final, but Catan Gesture Go Viral
Even though the emotional moment sweet heart, Yurdumspor still lose the championship.
But the club still get perspective pass result. Even though team no win, dem talk say dem glad say “a life was saved”.
For Catan, to win the match no kuku matter pass to save life.
“To help save life na em dey more important to me than say we lose di championship,” he talk.
The defender later explain wetin dey him mind that time.
“I no feel good at all when I see the seagull for ground; I just wan run go help am quick-quick. Na why I do CPR”, Catan talk.
Wetn surprise am pass be wetin follow.
“I no expect say I go receive messages from anybody. Right now, I dey receive congratulatory messages from people all over the world,” Catan talk.
The viral moment turn Yurdumspor captain to global hero, with fans dey praise his quick thinking and compassion during Istanbul playoff final.
Catan still reveal say him love animals.
“I dey always for animals side; like dis now, I get two cats, and I like to dey spend time with dem.”
As for the bird condition, he talk say:
“I no know wetin happen to the seagull; I just hope say em dey okay.”
Reports from Türkiye Today later talk say say “the bird get wing damage from the impact and e no fit fly for now”, but “dem don carry am go treatment.”
Dem even dey discuss for club side to add seagull to their logo as tribute to that unforgettable moment.
At the end, Yurdumspor lose the title. But for stadium for Istanbul, Catan show say sometimes the biggest victory no dey for scoreboard.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on March 3, 2026 10:23 am by Hitvibz Media




Stay connected