Na Rafiu Durosinmi first goal for di season help him team, Viktoria Plzen, land serious 5-1 win wey dem knack FK Pardubice for dia backyard as Czech First League waka start.
Di Nigerian baller no waste time at all—just two minutes afta dem sub am enter, baba tear net straight, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Na di fifth goal be that, wey finish work for Viktoria Plzen as dem use style take wash Pardubice for Friday night match for Stadion Arnošta Košťála.
Di 22-year-old no just score for style, him show say e no dey joke dis season. Guy man still dey hot from last season comeback.
Rafiu Durosinmi Score Just Two Minutes Afta E Enter Field
Plzen start di Czech First League 2025 season with fire.
Dem no even wait—Matej Vydra open scoring for 2nd minute like say na training.
By 29th minute, Karel Spacil double am—2-0. Plzen dey control di game like dem hold TV remote.
Small wahala show when Jemelka mistakenly put ball for him own net at 34th minute, but dem no shake.
Pavel Sulc come repair tins sharp-sharp with third goal just before halftime—3-1.
Second half never too waka, Vydra come nack another goal—e brace land for 55th minute. Di match don be 4-1.
Na that time dem carry Prince Adu commot and put Durosinmi for 65th minute.
As guy man enter, him no waste time—two minutes later, e jam ball go post, score number 5 for Plzen! Wahala don finish.
Di goal sweet, composed, and loud gan!
No forget say Durosinmi bin suffer serious injury last season, wey hold am down. But e still bounce back end of that season with 6 goals plus 2 assists inside 16 games.
This one na continuation of that ginger. Him dey hungry for more, and e clear for face say e ready run am.
Dis win give Plzen 3 solid points and warn dem next UCL opponent, Servette, say dem no come play at all.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 18, 2025 10:22 pm by Hitvibz Media



Stay connected