Moses Simon shut down Super Eagles revenge talk as Mahrez dey eye one last AFCON trophy with Algeria
Moses Simon don clear air say Super Eagles no dey think about revenge as dem prepare to face Algeria for Africa Cup of Nations (AFCON) 2025 quarter-final on Saturday.
The Nigerian winger yarn this one for press conference before the match go happen for Stade de Marrakech, Morocco, na weytin hitvibz dey yan be dat.
According to am, Eagles mind dey only on winning, not wetin happen for past.
Moses Simon talk unity as Super Eagles ready for Algeria
Naija dey enter the match with full confidence after dem scatter Mozambique 4-0 for last round, while Algeria manage knock out DR Congo 1-0 after extra time to reach the last eight.
Moses Simon explain say the strength of Eagles dey from unity and teamwork. E talk say na team work dey bring goals, no be magic, and everybody for the squad get role to play.
E still praise Victor Osimhen and Ademola Lookman, say dem be among the best players for Africa right now.
Both players don score three goals each for this AFCON 2025 tournament. Lookman don also give four assists, while Osimhen add one assist join.
But Simon quick add say individual glory no really matter if team no win. For am, the coach and players dey chase one goal — make Super Eagles succeed together.
“No time to dey argue who be the best on their own. Osimhen and Lookman na among the very best players for Africa, dem don prove am with the awards wey dem don win.
But wetin really matter na make the team succeed. We dey see ourselves as one, and the only thing we want na to win,” Simon talk.
Super Eagles show squad depth as Moses Simon kill revenge gist
Apart from Osimhen and Lookman, other Naija players don still score goals. Raphael Onyedika don net two, while Akor Adams, Wilfred Ndidi, and Semi Ajayi don score one goal each.
This one show say Eagles no depend on only one or two players.
When dem ask Simon about revenge for the 2019 AFCON semi-final loss to Algeria, e talk clear say that one no dey their mind at all.
According to am, Super Eagles focus na only to win, nothing more.
“Our mind no really dey on revenge sha. Di only thing wey dey our minds na to win,” em talk.
For Algeria side, dia captain Riyad Mahrez admit say pressure dey from home make dem win the game.
The former Manchester City star talk say both teams wan qualify, but na only the better side go go through.
Mahrez still hint say this AFCON fit be him last one. The 34-year-old talk say e no wan pressure himself, but e go sweet am well if e fit win the trophy for Algeria.
“Pressure dey for house make we win dis game. Na true say both teams wan pass, but na only di best fit pass, and I dey hope na we go. I dey feel say dis fit be my last AFCON, I no wan stress myself, but e go sweet if we fit carry di trophy come house,” he talk.
So far, Mahrez don score three goals for the tournament, no assist yet, and e don win just one Man of the Match award.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on January 10, 2026 7:15 am by Hitvibz Media




Stay connected