Ademola Lookman don find im groove again as e bang another correct goal wey help Atalanta package a well-deserved 2-0 win for Fiorentina on Sunday evening.

Ademola Lookman scoring in Serie A match

The Super Eagles winger pop up inside box like person wey know the script, slot Atalanta second goal sharp-sharp for New Balance Arena. Guy man dey hot again, no be small, na weytin hitvibz yan be dat

Ademola Lookman Strikes Again as Atalanta Takes Control

Baba follow up him goal-plus-assist combo for the 3-0 Champions League demolition of Frankfurt. Na back-to-back scoring form be this, omo the boy don dey feel himself again.

After the early-season wahala wey no gree leave am, the 28-year-old don dey gather steam ahead of AFCON 2025.

Ademola Lookman in action at New Balance Arena

Right now, him get three goals and one assist from 14 games across all competitions. Him run 77 minutes before Kamaldeen Sulemana show face for am.

  Gift Orban Burst Brain With Two Goals After AFCON Snub, Help Verona Scatter Fiorentina

Atalanta End Winless Run Under Palladino

Atalanta sef don finally commot for bondage as dem collect their first Serie A win under Raffaele Palladino. Na eight matches dem never smell victory before this one. Table wise, dem don waka go 11th.

From kickoff, both teams dey test themselves. Marco Carnesecchi and David De Gea turn the match to goalkeeper exhibition for first half — everybody just dey parry, dey fly up and down like NEPA light.

Atalanta finally break the lock before halftime as Odilon Kossounou curl one wicked cross-shot enter far corner — e even be like say na prayer answer for him first goal for the club.

  "No Look Gabon Like Small Pikin, Abeg!” — Mikel Obi Beg Super Eagles with Em Church Mind

Second half never start well for Fiorentina as Moise Kean still miss one sitter wey even beer-parlour keepers go score.

Ademola Lookman scores third goal of season

Before dem fit arrange themselves, one yama-yama clearance from corner bounce reach Ademola Lookman leg — baba no think twice, he tear net for Atalanta second goal.

Fiorentina try push late but Carnesecchi and the woodwork tell dem “mba.” Dem still remain winless and dey chill for relegation zone.

As AFCON 2025 dey drag near for December, Super Eagles coach Eric Chelle go dey smile like person wey see alert — because Ademola Lookman don dey return to correct form at the perfect time for club and country.

  Super Eagles allow Jordan chop draw, Emmanuel Fernandez score and Alex Iwobi collect red card
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 1, 2025 9:03 am by Hitvibz Media