E be like say Akor Adams don dey turn to Sevilla FC new superhero. The guy carry the team for head again, score the goal wey ginger Sevilla to win Villarreal 3-2 for inside their La Liga Matchday 36 game on Wednesday evening.

Akor Adams scores winning goal for Sevilla in La Liga

When fans think say the game don finish, Sevilla rise up like person wey drink ogogoro, dem come from two goals down shock the people wey get house for Estadio de la Cerámica.

Na Adams score that last goal wey scatter everywhere, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Akor Adams Carry Sevilla for Back Against Villarreal

No forget say for their last match against Espanyol, Adams enter from bench come score the winning goal after Sevilla first fall hand with one goal. The game end 2-1 that day.

The Nigerian star repeat the same thing against Villarreal. He score the winner again, and na back-to-back goals be that for the team wey dey struggle to commot for relegation.

  AFCON sidon-look Rafiu Durosinmi shine again, close 2025 with killa goal for Czech League

The 26-year-old striker don now reach 10 goals for league this season, plus three assists. If you add the one assist wey he get for Copa del Rey, e mean say he don contribute to 14 goals for this campaign.

Na the first time wey he don reach this milestone for one of Europe top five leagues.

Adams play for 86 minutes before coach change am for Andres Lopez.

This miracle win don give Los Rojiblancos hope say dem no go fall go second division. The result mean say Sevilla don win three matches straight, and dem break Villarreal record of six home wins in a row.

Akor Adams celebrating Sevilla comeback victory over Villarreal

Villarreal start the game with ginger, dem score first for 13 minutes through Gerard Moreno after Georges Mikautadze give am pass.

  Simy Nwankwo Scatter Hat-Trick, Make Al Orobah Wipe Al Tai, Don Hit 17 Goals for 13 Games

Seven minutes after, Mikautadze score the second one after Nicolás Pépé and Alberto Moleiro arrange the move.

Even though Yellow Submarine hold ball well, dem no fit score the third goal. Na so Red-and-Whites take see chance come back.

Sevilla Wicked Fightback Keep Dem for La Liga

The comeback start for 36th minute when Lucien Agoumé give Oso beta pass, and the boy use sense finish the ball.

Sevilla no gree, dem equalise for the extra time of the first half. Rubén Vargas intercept César Azpilicueta pass, come give Kike Salas wey use volley wire the net.

As second half start, Sevilla continue the pressure. For 72nd minute, the turnaround complete.

Akor Adams shines in Sevilla’s crucial La Liga win

Alexis Sánchez, Juanlu Sánchez, and Djibril Sow link up fine-fine before dem set the ball for Akor Adams. The guy just blast the ball pass Arnau Tenas enter the near post.

  Frank Onyeka: From Premier League bench-warmer to 2025/2026 EFL Champion inside 78 Days

Villarreal try everything to equalise for dying minute, but Sevilla defend like wall. This win don shift Sevilla far from the people wey fit drop from the league.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 13, 2026 9:28 pm by Hitvibz Media