Naija baller Peter Itodo still dey make waves for Ukrainian Premier League after he score again to save Metalist 1925 from loss for their house against Karpaty.

Metalist 1925 striker Peter Itodo in action versus Karpaty

As him team dey trail 2-1, the 22-year-old striker wire the equalizer to make sure say the match end 2-2 for that Round 28 clash, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Peter Itodo Dey Continue Him Goal Run for Metalist

Itodo don score for back-to-back games now for Metalist, and he don carry him score-sheet go seven goals for inside him last eight league matches.

If you check him total record for league this season, he don get 10 goals and one assist for 24 matches.

No forget say for their last match against LNZ Cherkasy, na him still score the equalizer to carry 1-1 draw. Before that one, he score the first goal for another 1-1 draw against Zorya.

  Daniel Job score solid goal again as Kongsvinger wire Raufoss to maintain beta start

If you add the five goals wey he don nak for Ukrainian Cup, the Naija boy don get 16 goal contributions for all competitions this season.

Apart from that, Itodo don reach double figures for league goals, and na him still be the Oga for the club scoring chart.

Peter Itodo celebrates goal for Metalist 1925 against Karpaty

He dey lead Denys Antyukh wey dey second position with six goals, and he gap him Naija brother, Christian Mba, with seven goals.

The match against Karpaty na real give and take because goals full ground.

Metalist first draw blood for 41st minute when Baton Zabërgja finish one correct move wey Sebastián Castillo start. This one give Metalist lead before half-time.

  Ex-Rivers Angels baller Olamide Adugbe burst net twice again as Žalgiris carry victory go home

But the visitors come back with ginger after break, especially Ambrosiy Chachua.

The midfielder draw the match level just seven minutes after they start second half, and after another seven minutes, he nak penalty to make the score 2-1.

Metalist Bounce Back for Serious Draw Against Karpaty

But Metalist no gree. Around 65th minute, Itodo show face to score the equalizer. He use another better pass from Sebastián Castillo finish the work for that beta match.

At the end of the day, the two teams share the points after plenty drama for second half.

Peter Itodo scores equaliser in Ukrainian Premier League clash

Even though Itodo dey try, the result still dey pain him and em teammates because they never win any match for their last five games—na four draws and one loss they get.

  Peter Itodo scatter everywhere, fire hat-trick as Mba join bodi for Metalist 4-0 win

However, this Saturday, Metalist 1925 go get chance to win when they play Epitsentr Kamianets-Podilskyi for house, so they fit move pass the sixth position wey they dey with 47 points.

After that one, they go travel go play Veres Rivne to finish the season.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 13, 2026 11:45 am by Hitvibz Media