Nigerian midfielder Emmanuel Ayaosi don sign for Czech champions SK Slavia Prague, and dis transfer na one of de biggest deals for MFK Karviná history. He and im teammate Pavel Kačor join de club together.

Emmanuel Ayaosi celebrating tophy win during his time at Karviná

Karviná confirm de matter for social media say de two players don commot, and dem yarn say de transfer na one of de biggest money deals wey de club don ever see, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Emmanuel Ayaosi Don Earn Big Move After Em Make History for Karviná

De club thank Ayaosi and Kačor for all de better work wey dem do, especially as dem help Karviná win de 2025/26 MOL Cup—wey be de first major trophy for de club history.

Slavia Prague officially confirm de deal on May 24, and de two players sign long-term contract wey go run reach 2030.

Slavia sports management talk say plenty top clubs for Czech Republic bin dey eye de two players, but na de Czech First League champions dem choose last-last.

  David Moses Score Late Winner for Slavia Prague as Oluwabunmi Babajide Finish Season with 9 Goals

Ayaosi waka for Karviná na pure grace. De Nigerian winger land de club for March 2023, and he start from de youth team before he shift go de reserve team.

Nigerian trio Emmanuel Ayaosi, Lucky Ezeh and Yahaya Danjuma celebrating Czech Cup success

By de second half of de 2025/26 season, he don become permanent first-team player and one of de baddest attackers for Karviná.

For de 2025/26 season, Ayaosi play 32 matches for all competitions, he score 6 goals and give 7 assists.

Im hand dey inside as Karviná take finish number 8 for de Czech top league, and dem lift de MOL Cup, wey be de first major trophy for de club history.

Ayaosi Stats and Trophy Wey Em Win for MFK Karviná

One of de biggest transfers for our club history don hapun! Midfielders Pavel Kačor and Emmanuel Ayaosi don move go Slavia Prague.

Champions, we wish una beta luck for de championship, and we dey wait to see una for Champions League pitch.

And thank una for de beta work wey una do for our club – na because of una we take win de cup,” Karviná write.

How Emmanuel Ayaosi Take Play For MFK Karviná:

  • When He Join Karviná: March 2023
  • Time Wey He Spend: Inside 3 years (2023–2026)
  • Im Record for 2025/26: 32 matches, 6 goals, 7 assists
  • Trophies Wey He Win: 1 (MOL Cup 2025/26)

De 21-year-old boy don level up for im career as he join Slavia Prague, where he go fight to win league trophies and fit even play UEFA Champions League next season.

  Kelechi Iheanacho don land for Celtic as Brendan Rodgers dey sharpen him striker squad

Emmanuel Ayaosi providing an assist for MFK Karvina at Mestský Stadion

Dis transfer na big level for de boy, as im growth for Karviná don dey make all Czech football clubs look am.

As he move so, de talented Nigerian winger go square up with im country brothers for Slavia—people like Igoh Ogbu, David Moses, Mubarak Suleiman, and Samuel Isife.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 27, 2026 7:01 am by Hitvibz Media