Naija baller Monday Etim dey burn for Denmark, no be small. Di guy don start this season for Danish 1st Division with fire, as e knack another goal wey help Hillerød collect 2-1 away win over Boldklubben af 1893 (B.93) on Friday evening.
Na him second goal be that for di season, and e don help Hillerød still dey maintain dem unbeaten run as dem dey top for table early early, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Monday Etim Double the Wahala After Arndal First Goal
For di Round 3 match wey shele for Sundby Idrætspark, Hillerød no gree play—dem burst out like say dem wan collect all three points by force.
Tobias Arndal first open di show for 21st minute after one sweet pass from Victor Dedes, wey e use finish cleanly.
Na just 13 minutes later, Arndal turn helper as e lay one better ball for Monday Etim, wey no dull at all—e push am inside net for 34th minute, make di score 2-0.
But B.93 come vex small—Mikkel Wohlgemuth come reduce di yawa with one goal for 43rd minute, make di home fans get small hope before halftime.
B.93 Try Come Back But Hillerød Hold Ground
Second half no too get gbas gbos again, but di two teams come play more with sense.
Coach comot Etim sharp sharp after second half start, bring in Mathias Veltz to hold midfield.
Even as Boldklubben af 1893 try press, Hillerød bone and hold tight till final whistle blow—na so dem collect another 3 points run am.
Now dem never chop any loss—2 wins and 1 draw—and dem dey sit gidigba for top of table.
Naija Baller Etim Still Dey Shine for Denmark
As e waka enter Hillerød from FC Helsingør as free agent last season, plenty people no expect say Monday Etim go burst like this.
But di guy don show say na him be correct signing.
Two goals already in just 3 games this season—omo, e dey ready to pass last season own wey na 14 goals in 34 games.
If e continue like this, Hillerød fit just dream promotion real soon.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on August 2, 2025 4:00 pm by Hitvibz Media



Stay connected