Naija Super Eagles striker, Gift Orban, dey shine steady ahead of 2025/26 season as e score correct opening goal wey help Hoffenheim knack Werder Bremen 3-0 for friendly match wey happen on Friday.

 

Gift Orban dey celebrate em goal for Hoffenheim vs Werder Bremen

Di 23-year-old Naija baller don score for two pre-season games now, e dey show say big season fit dey load, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Hoffenheim Use Style Run Show As Gift Orban Lead Di Front

Di match wey dem play for Silberstadt Arena Schwaz start calm, both Hoffenheim and Bremen no fit score for first half. But everything change sharp sharp once second half start.

  Gift Orban Tear Net, Create Another One but Verona Still Fall Hand vs Bologna for Serie A

Na just one minute enter second half, Orban use sharp eye score beta goal wey give Kraichgau boys lead.

When Gift Orban shoot beta shot for Hoffenheim vs Werder Bremen

Four minutes later, Wouter Burger come add another one make e 2-0 as dem dey run Bremen street.

Orban play 62 minutes before Ihlas Bebou replace am. But di boy don already do him job. Later later, Alexander Prass con finish work with third goal, make dem seal di win gbeske.

Orban Preseason Form Dey Mad – 2025/26 Go Hot?

No be today Orban start to ball. He don score before for the Hoffy boys 3-2 win against Freiburg, and e also play for dia 4-0 win over Homburg.

  Naija Boys Dey Hot: Elijah Odebe, Stephen Alfred, Friday Etim Burst Net for Europe

Dem Kraichgau guys don win four pre-season matches now, and dem still get one friendly against Metz on August 9 before Bundesliga proper go start.

Na four Nigerians kuku show face for the match as Die Kraichgauer waka comot with 3-0 win over Die Werderaner.

Gift Orban don Fire Hoffenheim past Werder Bremen for preseason

Na Orban carry the whole shine, Kevin Akpoguma hold ground for defence before dem sub am for Chukwu Emmanuel, while Benjamin Precious just siddon for bench like chairman all through.

With wetin we dey see so, Orban go dey key for di Kraichgau boys this season.

As e dey hot dey go, di Naija striker fit turn one of di Bundesliga players wey everybody go dey talk about.

  Gift Orban don score but Verona still fall yakata for late Serie A drama
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 3, 2025 8:39 am by Hitvibz Media