Moses Usor na one Nigerian player wey dey on fire right now. Guy just waka come from bench score correct match-winning goal wey carry him team, LASK, go Austrian Cup semifinals after dem quarter-final clash with Blau-Weiß Linz.

LASK players lift Moses Usor after Austrian Cup victory

Usor knack goal late for game to complete one koko comeback, as LASK flip two-goal deficit to beat BW Linz 3–2, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Moses Usor dey Spark LASK Austrian Cup Comeback

With only 15 minutes left, Nigerian forward bring am on replace Samuel Adeniran—and e no even take am 8 minutes for pitch, guy don already hammer important goal.

Moses Usor scoring winning goal for LASK in Austrian Cup

The 23-year-old goal na him first for cup this season, take him total goal contribution reach nine: six goals plus two assists in 16 Austrian Bundesliga games.

That strike still extend Usor scoring streak to five games straight for LASK, show say guy dey hot for form.

  Moses Usor reach double figures, Hilary Gong knack 2 goals as Naija ballers fire everywhere for world leagues

At one time, e be like say script dey write for Blau-Weiß side. Dem rush start game full speed, no fear, hush the Raiffeisen Arena inside 20 minutes.

Isak Dahlqvist knack early, Shon Weissman double the lead by 18th minute—LASK dey shake. Two goals down. Cup dream dey wobble. Derby pride dey gas.

But na cup football be this—things fit flip sharp sharp.

LASK finally balance body midway first half, and e matter well well.

  Moses Usor shine with goal, assist for LASK as Okoronkwo and Uchegbu ball wella for abroad

Sasa Kalajdžić pull one back by 35th minute, na goal wey no just change scoreline—e change mood. Belief begin enter body sharp sharp.

Nigerian forward Moses Usor turn Austrian Cup match into mad comeback story for LASK

After half-time, pressure come dey heavy. LASK dey press higher, move ball fast, Blau-Weiß begin dey feel am.

Epic Comeback Seal by Nigerian Forward Late Goal

Equaliser land by 57th minute through George Bello, and from there, match start dey tilt for red and white side.

Still, Blau-Weiß no gree. Tackles dey fly, nerves dey tight, every attack dey feel like matter of life.

As penalties dey near, Moses Usor hammer the killer blow by 83rd minute, finish off solid attacking move, complete one amazing comeback.

  Moses Usor shine with goal, assist for LASK as Okoronkwo and Uchegbu ball wella for abroad

Nigerian forward Moses Usor celebrates epic comeback goal

From 0–2 down to 3–2 winners, LASK don knack the tie finish.

Derby night. Five goals. One comeback wey nobody go forget.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on February 3, 2026 9:46 am by Hitvibz Media