Al-Ittihad don officially confirm say dem don sign Nigerian young striker George Ilenikhena from French club AS Monaco.

Al-Ittihad unveil Nigerian striker George Ilenikhena

Di Saudi Pro League champions drop di announcement for their verified social media pages, as dem finally end all di long gist and speculation about where di striker go land, na weytin hitvibz dey yan be dat.

George Ilenikhena don join Al-Ittihad after Monaco run

Sources talk say di Tigers agree €33 million deal with Monaco for di 19-year-old forward, and dat one make am one of di youngest Nigerian players wey don make big-money move go Middle East.

  Troost-Ekong See Premium Shege as Cristiano Ronaldo Drop Goal No. 928 for Al-Nassr Sweet Show

Ilenikhena join Monaco for summer 2024 and e no waste time before e show say e be correct squad player.

For di French side, di Nigerian striker play 51 matches, score 10 goals, and add two assists across all competitions.

E play big role for Monaco strong 2024/25 season, as dem finish top three for Ligue 1 and still perform well for UEFA Champions League.

With hin strong body, sharp movement, and eye for goal, Ilenikhena dey always cause problem for defenders and remain one steady attacking option for di club.

  Asisat Oshoala Score Her 16th Goal, But Francisca Ordega Chop Bragging Right for Super Falcons Derby

Di Lagos-born striker wey grow football for France really catch Europe eye when e score di winning goal against Barcelona as Monaco return to Champions League.

Al Ittihad don secure Nigerian talent for di future

For last season, Ilenikhena feature for 20 matches across Ligue 1, Champions League, and Coupe de France.

George Ilenikhena during Monaco Champions League match

E score important goals, including away goals against AJ Auxerre for di league and US Orléans for Coupe de France round of 16.

Now, e don officially become new Tiger, as Al Ittihad dey plan how dem go slot am inside their attacking setup for di new season.

  Troost-Ekong Chop Better Red Card as Benzema Hat-trick Scatter 10-man Al-Kholood
Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Last Updated on February 3, 2026 1:43 pm by Hitvibz Media