Super Eagles forward Akor Adams don ignore all the gbas gbos wey dey outside about their head coach, Eric Chelle, as dem dey prepare for their second AFCON 2025 Group C match.

Akor Adams shuts down Eric Chelle critics — “He knows what he’s doing”

The Sevilla baller don talk say the whole team dey fully trust coach Chelle and the way him dey plan matches, as Naija set to face Tunisia, na weytin hitvibz dey yan be dat.

AFCON 2025: Akor Adams trust Chelle plan wella

Nigeria go enter Saturday match with better morale after dem win Tanzania 2-1 for their first game, wey help dem collect early three points.

  Peter Olayinka: From Champions League Baller to Cyprus — Super Eagles Star Don Join APOEL

Eric Chelle leads Super Eagles preparations for AFCON 2025

Tunisia no be small team too, as dem also come strong after dem beat Uganda 3-1, setting stage for serious Group C battle.

Adams, wey play against Tanzania, even hit crossbar and nearly assist Victor Osimhen, make am clear say players get full belief for the coach wey dey sideline.

As e yarn with journalists on Tuesday, the striker talk say:

E know wetin be best for every match, and from previous games, e don show say e sabi wetin e dey do.

“We trust am, and e go always bring the best plan come.”

Akor Adams backs Eric Chelle to win AFCON 2025

Super Eagles dey eye Tunisia win with full confidence

The Sevilla striker still dey sure say Super Eagles get everything wey dem need to collect full points against the North Africans. E talk say Naija style and energy dey different.

  Victor Osimhen score em 20th goal as Galatasaray nack Fenerbahce for Intercontinental Derby

If you compare us to North Africans, we for west get plenty intensity; we dey play with strong aggression.

So we get wetin e take do the work. Against Tunisia, we just need come out like we always do, be ready, and make we see how e go be.”

Super Eagles training ahead of Tunisia clash at AFCON 2025

As preparation dey continue, Super Eagles don return to training ground on Wednesday to arrange final plans for the Tunisia match, with full focus on building momentum for AFCON 2025.

  Christantus Uche No Dey: 10-Man Leeds Hold Crystal Palace for Selhurst Park
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on December 25, 2025 6:36 am by Hitvibz Media