Di President Federation Cup Round of 16 match between Rivers United and Nasarawa United bring correct action inside Awka Stadium on Saturday.
As dem beat Enugu Rangers reach dis stage, di Pride of Rivers show body say dem no come play at all right from di beginning of di match, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Nasarawa shock Rivers United with 2-goal lead
Ubong Friday and Bello Babatunde fire early shots, testing Nasarawa defense with plenty attempts wey almost enter net.
But football fit wicked wella—even as Rivers dey press dem early, Nasarawa United star Ugochukwu Leonard score one unexpected goal just before half-time whistle blow.
Finidi George change tactics for half-time, carry new players enter field to find equalizer. Instead, water pass garri as Ada Umar score second goal for Nasarawa for di 68th minute.
As match don dey reach end and dem dey 2-0 down, many teams for don give up. But no be di Garden City boys.
Super-sub Samson Obi give dem hope as he score one goal back just three minutes before stoppage time.
Den, as di match wan just finish, Handsome Surveyor score correct equalizer to complete dia sweet comeback and carry di match go penalty!
E pain say, all di energy wey dem take fight back for 90 minutes no reach make dem win di penalty shootout. Nasarawa United hold dia side well, score dia kicks to win di shootout 5-3.
For Finidi and im boys, e really pain dem to comot for di competition like dis after dem show correct fighting spirit, and even as dem just lose di league title to Enugu Rangers with small margin.
Meanwhile, twale to Nasarawa United—dem survive di tough match for Awka and waka go quarterfinals, where Plateau United dey wait dem!
Enyimba fall out as Ikorodu and El-Kanemi move forward for Federation Cup
Enyimba too don comot for di competition after Ikorodu City beat dem 5-4 for penalty shootout inside dia Round of 16 match for Samuel Ogbemudia Stadium for Benin City on Saturday.
Dem gats go penalty after di two teams play 1-1 draw for 90 minutes.
Di People’s Elephant score first through Jacob Jonathan for di 25th minute, and e be like say dem go reach quarter-finals.
But Aderemi Adeoye break Enyimba heart, score one serious equaliser for Ikorodu City just eight minutes before match finish.
Inside di shootout, di Oga Boys stand wella score all dia five penalty, while Enyimba fall hand as dem score only four.
After dis shaking, Ikorodu City go face Barau FC for di quarter-finals.
How everywhere be for Federation Cup:
E be day of pure action across di country, as dem decide oda Round of 16 matches:
El-Kanemi Warriors beat Bendel Insurance 8-7 for one long penalty shootout after heavy draw.
Barau FC secure dia quarter-final spot against Ikorodu City as dem flog Sunshine Stars U-19 2-1.
Plateau United win FC Basira 2-1, as Paul Magit and Dawa Victor put ball inside net to make sure dem move forward.
Wikki Tourists too secure dia ticket to di next round with one easy 3-1 win over Kada Warriors.
Full Results for President Federation Cup Round 16
Sokoto United 2-0 Adamawa United
Bendel Insurance 3-3 (PK: 7-8) Elkanemi Warriors
Kada Warriors 1-3 Wikki Tourists
Bida Lions 0-1 Flight FC
Rivers United 2-2 (PK: 3-5) Nasarawa United
Plateau United 2-1 FC Basira
Ikorodu City 1-1 (PK: 5-4) Enyimba FC
Sunshine Stars U19 1-2 Barau FC
Quarter-Final Matches
Sokoto United Vs Elkanemi Warriors
Wikki Tourists Vs Flight FC
Nasarawa United Vs Plateau United
Ikorodu City Vs Barau FC
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on June 7, 2026 9:06 am by Hitvibz Media
Related
Kasala for Finidi! Nasarawa United survive late Rivers United scare to win Federation Cup shootout



Stay connected