Naija pikin Elijah Odebe just dey carry him hot form from last match, still dey fire goals anyhow for FC Sheriff.

Nigerian forward Elijah Odebe celebrates after equalising

But this time? Baba try, e still no reach to save hin people for UEFA Conference League wahala against Anderlecht on Thursday night, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Elijah Odebe Score, But Sheriff Just Manage Draw

Sheriff host the Belgian boys for Zimbru Stadium. Game don dey die, Odebe come knack late goal wey ginger the home fans.

FC Sheriff vs Anderletch UEFA Conference League qualifier

Las las? 1-1 draw.

Na the 18-year-old wey burst net to save dem from kpai in front of their home supporters.

  Simeon Nwankwo Don Run Am Again! Him 5th Serie B Goal Help Salernitana Win, Send Cittadella Go Relegation

But make we no lie, all the shakara no stop the Belgian boys from waka go next round — aggregate na 4-1 against Sheriff.

Remember say first leg na total punishment: Anderlecht flog dem 3-0 like say dem dey play friendly for backyard.

Still, our Naija striker dey prove say e no be anyhow baller. Him don dey deliver goals steady-steady.

How the Second Leg Take Happen

Na 81st minute, Odebe drop hin bomb. Sheriff equalise sharp-sharp after Nathan Saliba don pain dem heart for 71st minute.

The first wahala start when Adriano Bertaccini serve corner wey land for Saliba leg. Baba just lace am straight inside right post — goalkeeper just dey watch like cinema.

  Victor Olatunji: Naija Baller Wey Dey Ginger Don Land For MLS, Join William Agada For Real Salt Lake

But no worry, Amarildo Gjoni no dull. E see Odebe free inside box, gbam, pass land. Our boy just cool body, roll ball pass Colin Coosemans like say na Saturday training.

Elijah Odebe scoring for FC Sheriff against Anderletch

Back to Local Palava

Na Elijah Odebe second goal back-to-back for Sheriff, third goal in just seven games this season.

And before all the goals, Anderlecht even miss penalty — Mario Stroeykens blow am first half.

Now wey Europe don close for FC Sheriff, dem go face home battle. Next stop? Sparta Selemet for Moldovan Super Liga Round 9.

  Ejike Opara Goal No Do as Novi Pazar Wahala for Conference League Start

Make dem no go carry the European heartbreak go domestic league o, because fans no go gree.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on August 15, 2025 8:00 pm by Hitvibz Media