Na for Thursday night like dis na em Naija footballer show say dem still dey on top as fresh boys burst net anyhow for Europe — Elijah Odebe, Stephen Alfred and Friday Etim no dull at all, dem carry goal scatter ground for dia clubs.

Di three of dem goal help dia team secure beta win for UEFA match and pre-season games, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Odebe Last-Minute Thunder for FC Sheriff

Odebe no waste time show him level for FC Sheriff for Moldova as dem jam FC Prishtina from Kosovo for UEFA Europa League Qualifier.

Elijah Odebe don score goal for FC Sheriff Moldova

Di 18-year-old baller enter pitch as sub for 67th minute come nack one solid goal wey make dem pack 4-0 win for house.

Di match bin dey 2-0 when Odebe enter — thanks to Cyrille Bayala wey knack two quick goals.

  Ademola Lookman Don Become Atlético Madrid Player After Europa League Big Show

Bayala come still complete hat-trick for 74th minute before Odebe put final nail for coffin with di fourth goal for Bolshaya Sportivnaya Arena.

Stephen Alfred & Friday Etim No Dey Carry Last

For Belarus, Alfred still show him striker vibes for Torpedo Zhodino as dem face Rabotnick from North Macedonia for UEFA Conference League.

Stephen Alfred dey celebrate UEFA Conference League goal

Na bench Alfred dey chill before coach call am enter — e replace Maksim Skavysh for 57th minute. Dem don dey lead 1-0 that time after Pavel Sedko score early.

Seven minutes later, Vadim Pobudej add another one make am 2-0 before Alfred use last-minute goal knack di third one for 93rd minute. Beta 3-0 win as dem dey go second leg sure die.

Etim sef no carry last — him burst net for friendly match wey FC Midtjylland play with Dynamo Kiev.

Friday Etim kuku score winner for FC Midtjylland

Di 23-year-old striker wey just come from Mafra show fans say e no come dey look face — him score di last goal wey seal di 3-1 comeback win for Thermen Stadion.

Dynamo Kiev first score through Oleksandr Pikhalyonok after 21 minutes, but Franculino equalise 12 minutes later.

Second half, Mikel Gogorza give Midtjylland lead before Etim finish work.

Now, Odebe and Alfred go wan carry di hot form enter di second leg of dia Europe matches, while Etim go dey ginger to gain more trust and fire goals for Midtjylland when dem resume action.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 11, 2025 12:55 pm by Hitvibz Media