Super Eagles forward Kelechi Iheanacho don start to show face for scoresheet again, as he score beta goal wey give Celtic FC 2-1 away win against Dundee FC for Scottish Premiership.

Kelechi Iheanacho in action for Celtic vs Dundee FC

Iheanacho enter from bench come wire the winning goal late for the game. This win sweet Celtic well-well because e help dem bounce back after dem lose to Dundee United for their last match for Dens Park, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Kelechi Iheanacho end him dry season with winning goal

The Nigerian star enter the match for 58th minute to replace Tomas Cvancara, and e no take am pass 24 minutes to show say he be senior man for that round 32 clash.

The 29-year-old striker don get three league goals now for this season. The last time wey he score na since October 5, 2025, when Celtic beat Motherwell FC 3-2.

Since that time, he don play 12 games without any goal. He break that 182-day (six months) dry season to finally find him scoring boots again.

  Uganda vs Nigeria Preview: Super Eagles Wan Use Vex Sweep Group C for AFCON 2025

Because of this Iheanacho late goal, Celtic don close the gap on top the Scottish Premiership table.

Celtic start the match with ginger and dem take lead early through Yang Hyun-Jun, but dem waste plenty chances to finish the game.

Dundee come equalize for second half after Simon Murray score penalty wey VAR give dem.

Kelechi Iheanacho celebrating his goal with Celtic teammates

As the game wan end, Iheanacho come from bench come blast the winner. Dundee later collect red card remain 10 men, while Celtic move closer to the top since Hearts don fumbuz for their own match.

  "No Look Gabon Like Small Pikin, Abeg!” — Mikel Obi Beg Super Eagles with Em Church Mind

Sadiq show liver but Valencia still fall hand

For Spanish La Liga, Umar Sadiq give assist but e no reach as Valencia CF lose 3-2 for house against Celta Vigo for Mestalla Stadium on Sunday.

Sadiq start the game for bench as the coach, Carlos Corberán, choose to start other strikers.

The Nigerian international enter for 63rd minute to replace Hugo Duro as Valencia dey try find way to escape defeat.

The former Rangers FC striker show him level late for the game as he set up the ball for Guido Rodríguez to score Valencia second goal for extra time.

Umar Sadiq assists late goal for Valencia in Celta Vigo clash

Sadiq don get one goal and one assist now for inside 11 league matches wey he play for the Black and Whites.

  Salim Lawal: Viktoria Plzen Oga Don Hail Super Eagles Star After Em First Goal — ‘Em Behave Well’

He m.ove permanently from Real Sociedad this January, after he spend the second half of the 2024/25 season for there on loan.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 5, 2026 8:50 pm by Hitvibz Media