Super Eagles striker Victor Osimhen don show say him be Baba again as him score beta goal wey help Galatasaray win di big Intercontinental Derby against Fenerbahce for Sunday Turkish Super Lig match.
Osimhen na him start di scoring as Galatasaray collect 3-0 victory for RAMS Park inside di Matchday 31 game, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Victor Osimhen Answer Critics as Galatasaray Win Derby
Before di match start, wahala first gas as Fenerbahce go report Osimhen to Turkish FA. Dem dey complain say di protective gear wey he wear for him hand no safe for other players.
Di Nigerian forward just come back from hand injury, na why he dey wear di guard, but di rivals bin wan use am draw him leg.
Instead make he talk too much, Osimhen answer dem for pitch.
After di game start with tight defense, Galatasaray break di deadlock for 40th minute.
Mario Lemina give Osimhen fine pass, di guy just use sharp sense pass two defenders before he coolly fire di ball enter left corner.
Dis goal na another proof say Osimhen sabi different ways to score—since season start, he don use head, leg, and even knee take score.
As he score finish, he do eye-dey-cry celebration take yab Fenerbahce people because of di complain wey dem make before di match.
Galatasaray bin think say dem don score second goal for 56th minute when Lucas Torreira fire one low shot enter net, but VAR cancel am say na offside.
Osimhen Goal Push Galatasaray Nearer to Trophy
Di home team no gree cool down, and after six minutes, things worse for Fenerbahce as referee Yasin Kol give Ederson second yellow card (red card) because he dey argue.
Galatasaray use di advantage well-well. Baris Alper Yilmaz score penalty with chest, he send di goalkeeper go school to make am 2-0.
For di end of di match, Fenerbahce defense mess up. Lucas Torreira carry di ball and nack am enter net to finish di game 3-0.
Osimhen Stats Dis Season:
League: 13 goals & 4 assists (20 matches)
Champions League: 7 goals & 1 assist
Total: 20 goals (25 goal involvements)
Dis win don make Galatasaray gap everyone with 7 points for top of di table. As e be so, only three matches remain, and di trophy don almost reach dem hand.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on April 26, 2026 9:32 pm by Hitvibz Media
Related
Victor Osimhen score em 20th goal as Galatasaray nack Fenerbahce for Intercontinental Derby



Stay connected