Ademola Lookman don show him level again as Atlético Madrid pick ticket for UEFA Champions League semi-finals. Dem beat Barcelona after two heavy matches wey full with drama.

Ademola Lookman scores against Barcelona semi final clash

Our Super Eagles star show say he be big player for big match. Even though Atlético lose 2–1 for house, the goal wey Lookman score make sure say dem qualify with 3–2 aggregate, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Ademola Lookman Goal Na Im Save Atlético

Barcelona start the match with ginger. Lamine Yamal first test Juan Musso before he score the first goal. E no kitay, Ferran Torres add another one, and pressure come start to wire Atlético.

But na there Ademola Lookman take show him power. For one key moment, he cool down finish the ball well to reduce the lead and put Atlético back for front for the aggregate score.

After that goal, Atlético change style. Dem pack bus for back and dey wait make dem catch Barca for counter-attack.

  Victor Osimhen Drop Two Assists as Galatasaray Mash Up Eyupspor 5-1 for RAMS Park

Ademola Lookman Atletico Madrid Champions League action

Barca try all dem fit try. Torres even think say he don score another one, but VAR talk say na offside.

As the match dey end, Eric García collect red card, and na so Barcelona hope take quench. Even with all the pressure, Atlético hold ground till match finish.

Lookman Talk After the Strong Match

As he dey talk about the game, Ademola Lookman admit say the match really hard for Atlético Madrid, especially as dem fall behind for early stage.

To dey 2-0 down no easy at all. The game get two sides; we just hold our heart, we struggle am out. We no win tonight but the main thing be say we don reach semi-finals,” the winger tell TNT after the match.

That him goal na im be the K-leg for the whole tie. E show say since he leave Atalanta join dem for January, he don turn “senior man” for the team.

  Josh Maja Score but West Brom Fumble as Arthur Okonkwo Help Wrexham Do Comeback

The 28-year-old boy don get 10 goal involvements for Atlético Madrid now—six goals and four assists for all competitions. For Champions League alone, he don get two goals and one assist.

Ademola Lookman celebrates goal vs Barcelona UCL

Lookman play for 66 minutes before Nicolás González come replace am, and the fans give am respect for the work wey he do.

Lookman don rise reach number three for Nigeria all-time top scorers list for UEFA Champions League, na only Victor Osimhen and Obafemi Martins dey ahead of am.

Victor Osimhen — 16 goals for 27 matches
Obafemi Martins — 9 goals for 34 matches
Ademola Lookman — 8 goals for 21 matches

Atlético go come wait for the person wey win between Arsenal and Sporting CP. For now, the London boys (Arsenal) get small advantage as dem dey go the second leg.

  Emmanuel Dennis: Super Eagles Forward Wey Everybody Don Forget Don Show Face for Danish Club
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on April 15, 2026 1:58 pm by Hitvibz Media