Bayelsa Queens carry sharp 2-1 win beat Rivers Angels for this NWFL Super Six South-South derby wey happen for Adokiye Amiesimaka Stadium.
Di match get plenty tension, goals and post-match hot talk as coach Whyte Ogbonda explain wetin really guide him plan for di game, na weytin Hitvibz dey yan be dat.
NWFL Super Six Bayelsa Queens vs Rivers Angels tactical gist
“Yeah, definitely. I know di house, and I know di style of play dem normally play, and knowing too say dis match, we need am because anybody wey lose dis match today don commot for Super 6 contention.
So, I try make sure say dem go all out so we fit collect di three points wey dey at stake because as defending champions, we no fit just come here come lose anyhow. So by di end of di day, di players collect di three points for us.
Like I don talk before, you know, dis na my community, dis na my area.
Di land go favour me especially when e concern Rivers Angels, and na exactly wetin happen today,” the coach talk.
Bayelsa Queens start strong and manage use set-piece take draw first blood before Rivers Angels respond through penalty, but Bayelsa quickly punish dem back and carry di win.
NWFL Super Six title race pressure as Rivers Angels crash again
“Definitely, we still get hope because we dey expect say more upset go still happen. Just like wetin happen between Rivers Angels and Abia Angels because everybody dey look Abia like say dem no even dey Super 6 at all.
But by di end of di day, you see wetin happen for dat match. So hopefully, I dey sure say some upset still go happen. And when dem upset happen, e go favour us.
So, we still get hope say we dey inside di title race because we still get two matches to play, and with those two matches, if we fit win am, we fit end up with ten points. We believe say ten points fit still give us di trophy, and na wetin we dey pray for,” di coach talk.
Di defeat mean say Rivers Angels don suffer back-to-back loss, while Bayelsa Queens don bounce back sharply to keep dem Super Six dream alive.
“Dem too lazy and dull” — Bayelsa Queens coach explain attacking approach
“Well, ball possession no dey score goal. Our own target na to score more as we still dey try defend.
And since I notice say di central defence of Rivers Angels too lazy and dull, I gats push more attackers go there. I tell my players make dem dey give dem long ball so we fit break dia defence. And I think say na dat one bring us di two goals wey we score.”
Bayelsa Queens use direct long-ball approach punish Rivers Angels for second half, and dat tactical decision eventually decide di tight derby.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on June 11, 2026 2:18 pm by Hitvibz Media
Related
“Dem too lazy and dull” — Bayelsa Queens coach Scatter Rivers Angels after 2-1 win for NWFL Super Six




Stay connected