The 2026/2027 Nigeria Women Football League (NWFL) Premiership draw don finally land for Abuja, and Matchday 1 don already set to scatter everywhere!

Defending Champions Edo Queens Face Rivers Angels in Blockbuster Opener

Reigning champions Edo Queens—wey knack Rivers Angels 2–1 inside 2026 Super Six before dem carry cup—go start dis new season as dem go jam di seven-time champions inside one big Group A gbas-gbos, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

For di other side, Group B get one heavy opening clash as 6-time winners Bayelsa Queens go lock horns with Nasarawa Amazons, wey beat dem 2–1 for last season Super Six.

  “Na pure offside” — Edo Queens coach dey vex about Rivers Angels match-winning goal

Pelican Stars wey just promote come back Premiership go also test power with Ibom Angels.

NWFL Premiership Draw: All Di Full Groups (16 Teams):

Group A: Edo Queens, Rivers Angels, Rangers Int’l Women, Abia Angels, Adamawa Queens, FC Robo Queens, Ahudiyannem Queens, Sunshine Queens.

Rivers Angels in training

Group B: Bayelsa Queens, Remo Stars Ladies, Nasarawa Amazons, Delta Queens, Heartland Queens, Ekiti Queens, Pelican Stars, Ibom Angels.

  Rivers Angels star Abasiofon Uwah no dey among NWFL February Player of di Month nominees

Matchday 1 Fixtures:

Group A: Edo Queens vs Rivers Angels (Star Opener) | Rangers Int’l Women vs FC Robo Queens | Abia Angels vs Ahudiyannem Queens | Adamawa Queens vs Sunshine Queens

Group B: Bayelsa Queens vs Nasarawa Amazons | Ibom Angels vs Pelican Stars | Heartland Queens vs Ekiti Queens (Remo Stars Ladies vs Delta Queens)

Edo Queens in training

Between Group A and Group B, which one be di real “Group of Death”—and who go carry all 3 points for Edo Queens vs Rivers Angels opening match?

  "I go celebrate" — Rivers Angels baller Grace Saliu yan before she go face her old team Naija Ratels

Drop una predictions for comment section!

Last Updated on November 26, 2026 4:19 pm by Hitvibz Media