Super Falcons striker Blessing Nkor continue her hot form for Belarusian Vysshaya Liga Women as she score again make Dynamo Brest trash Dyussh-Polesgu 4-0 for away match.

Dynamo Brest attacking play featuring Blessing Nkor

Di one-sided match see di 22-year-old open di scoring as Dynamo Brest ladies control di game from beginning to end for Volna Stadium on Sunday afternoon, na weytin Hitvibz dey yan be dat.

Blessing Nkor Dey Continue Her Goal-Scoring Run

Nkor don now score for four league matches back-to-back. She don score six goals for her last four games and help Dynamo Brest win four league matches straight.

Di Nigerian forward don also score eight goals from eight league matches dis season, as she continue to show say she na one of di most important players for di Brest side.

Dynamo Brest women still maintain dia perfect record against Dyussh Polesgu after another convincing victory, as dem continue to put pressure on di leaders for Belarusian Women’s Premier League.

  Super Eagles and Super Falcons baller don scatter Europe as Chukwueze, Payne dey run show

Just before halftime, Dynamo Brest score two quick goals wey scatter di hosts’ confidence and take full control of di Matchday 9 clash.

Dyussh-Polesgu 0-4 Dynamo Brest with Blessing Nkor

Dyussh Polesgu try hold Dynamo Brest for most of di first half, but di breakthrough finally come for di 45th minute.

Na Nkor break di deadlock after she use one defensive mistake from di home team take score di opening goal.

She collect the ball for inside 18-yard box, use correct dummy take deceive the goalkeeper, before she gently push the ball enter the empty net.

Before Dyussh fit recover, Dynamo strike again deep into first-half stoppage time.

  Chinwendu Ihezuo Tear Net Again Make Pachuca Scatter Necaxa for Liga MX Femenil

Olga Kapysha make am 2-0 just two minutes later, leaving di home side with plenty work to do after halftime.

Nkor Dey Lead Dynamo Brest Title Chase

Di second half still follow di same pattern as Dynamo women continue to dominate possession and control di match.

Late for di game, Nkor and her teammates completely kill off di contest with two quick goals inside two minutes.

Diana Osmolovskaya score di third goal for di 79th minute before Anastasia Evzrezova add di fourth goal two minutes later to complete di 4-0 victory.

Blessing Nkor scoring in Belarusian Vysshaya Liga Women match

Di result mean say Dynamo babes don beat Dyussh Polesgu 10 times straight since 2023.

With dis victory, Dynamo babes don gather 24 points from nine league matches, winning eight and losing only once as dem continue dia chase for di league title.

  Asisat Oshoala no get joy! She fire hat-trick take carry Al-Hilal enter SAFF Women’s Cup final

Meanwhile, Dyussh still dey 11th position for di table with only three points after nine matches dis season.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on June 28, 2026 7:40 pm by Hitvibz Media