Odion Ighalo don finally wake up: Burst net, end 9-game drought as Al Wehda scatter Al Raed

Odion Ighalo
Share this

For 49 days, Odion Ighalo waka upandan for field, dey find goal, but e be like say football god don forget am. Nine matches, zero goals—critics don dey talk say e don lose touch after all the tithe wey em pay.

Odion Ighalo don finally wake up: Burst net, end 9-game drought as Al Wehda scatter Al Raed

But for King Abdul Aziz Stadium on Thursday night, Baba show say fire still dey him body as e finally burst net, help Al Wehda knack Al Raed 3-1 for house, Hitvibz reports.

Na wetin dem need be that, because before this match, dem don suffer anyhow. Loss full everywhere, moral don fall, relegation dey look dem face.

But as Odion Ighalo break the curse, hope don return for Al Wehda side.

Odion Ighalo burst em 9-game drought with correct goal

Odion Ighalo don finally wake up: Burst net, end 9-game drought as Al Wehda scatter Al Raed

Match never even settle when wahala start—Karim El Berkaoui put Al Raed ahead for 16th minute, come make Al Wehda fans begin fear say another bad day don land.

But dem no gree. Just eight minutes later, Saad Bguir equalize, show say dem ready fight.

First half end 1-1, tension full ground. But as second half start, na then Ighalo show why dem dey call am senior man.

E catch better chance, no waste am—boom! Net shake, 5th league goal for am this season, and most important one because e end im 9-game goal drought.

Al Raed wan push for equaliser, but dem no know say wahala still dey.

Before dem fit balance, Alexandru Crețu give dem final blow—3-1, game over, Al Wehda don finally smell victory after weeks of pain.

Odion Ighalo don finally score again

Win sweet, but relegation battle never finish

Even though Al Wehda don win this match, wahala never end. Dem still dey bottom of Saudi Pro League with 17 points from 24 games.

Al Raed dey just one point ahead for 16th position, meaning say fight never finish.

Only 10 matches remain for season, so Odion Ighalo and him guys go need ginger if dem wan escape relegation wahala.

Next stop—Al Khaleej, and another chance for Ighalo to shine.

Odion Ighalo don finally wake up

Meanwhile, the former Manchester United striker don still dey talk about him journey for football.

For Rasheedat Ajibade’s Rash4Christ podcast, e yarn about how e take sacrifice pay cut just to play for Premier League.

Plus, e reveal say e never miss tithe since 2005—football and faith dey hand in hand for am.

For now, Al Wehda dey celebrate, but the real battle still dey ahead. Odion Ighalo fit carry dem escape relegation? Time go tell sha!

Like this post?
We’d be delighted to hear from you. Please leave a comment in the box below!

Be the first to comment on "Odion Ighalo don finally wake up: Burst net, end 9-game drought as Al Wehda scatter Al Raed"

Leave a Reply