Jennifer Echegini don score 5th goal dis season as Juventus and Inter Milan nack draw gidigba

Jennifer Echegini don score 5th goal dis season as Juventus and Inter Milan nack draw gidigba

Super Falcon star Jennifer Echegini no dey gree for anybody dis season for Serie A women’s football, she don go score another goal wey help Juventus gather draw against Inter Milan.

Jennifer Echegini don score 5th goal dis season as Juventus and Inter Milan nack draw gidigba

Echegini bin score for second half and e help Juventus draw 3-3 against FC Internazionale Milano for weekend, Hitvibz reports.

Di 22-year-old midfielder, wey enta match from bench, score for Women’s Serie A Italian Derby with Inter, even though she play only 31 minutes.

This goal make am five goals for seven League matches wey Echegini don play for Juventus since she join dem for January.

Di two teams bin dey play wella for Arena Civica Gianni Brera on Sunday afternoon and e no tey before Flaminia Simonetti score penalty for di home team after 17 minutes.

  Jennifer Echegini: Super Falcons Baller Shoe Shine but PSG Manage Draw for Lens

But Cristiana Girelli sharperly equalise for Juventus seven minutes before halftime kuku reach.

Inter con score again as dem begin second half and na Michela Cambiaghi score the goal, but Juventus still manage equalise again for 58th minute through Arianna Caruso.

Small time, Echegini score goal her own goal wey give Juventus lead for the first time for di match,

  Jennifer Echegini: Super Falcons Baller Shoe Shine but PSG Manage Draw for Lens

Jennifer Echegini don score 5th goal dis season as Juventus and Inter Milan nack draw gidigba

but Inter stubborn head too much, dem score back, Annamaria Serturini na em score di goal just four minutes before the Ref go blow final whistle, wey come make the game end 3-3.

The draw kuku put Echegini and her teammates for second place for league table, dem dey seven points behind league leaders Roma, but dash Inter better gap as dem dey fifth position with 17 points.

Next match wey dey for Echegini and her teammates dem for Juventus na against Fiorentina for their house on Saturday.

  Jennifer Echegini: Super Falcons Baller Shoe Shine but PSG Manage Draw for Lens

You like dis post?
Abeg, drop your comment for di box below, we go happy well well to hear from you!

About the Author

Kris
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "Jennifer Echegini don score 5th goal dis season as Juventus and Inter Milan nack draw gidigba"

Leave a Reply