Super Eagles coach Eric Chelle dey jubilate for Rwanda win: “Na we dominate dat match”

Super Eagles coach Eric Chelle revels in Rwanda Victory - We dominated the game

Na rugged fight wey Super Eagles pull off as dem knack Rwanda 1-0 for di 2026 World Cup qualifier, but no be di slim win wey scatter talk, na di bold mouth wey oga coach Eric Chelle use after match wey dey hot gist everywhere.

Super Eagles coach Eric Chelle on the sidelines in Rwanda Victory

Na Tolu Arokodare, di super-sub wey just waka enter, fire di killer goal for Saturday evening. Na im save di day for Uyo, na weytin hitvibz yan be dat

Eric Chelle dey hail him Eagles after Rwanda match

Fans dey para small say di ball no too sweet, but Chelle dey brag say na domination dem play.

After match, baba coach dey shine teeth:

I happy say we collect three points plus di way we take ball. First half na pure one-way traffic. We hold like 70 percent possession, na we dey press dem anyhow,” Chelle yan.

Super Eagles forward Osimhen injured during Rwanda Victory

E still explain how e switch gear for second half:

Rwanda boys don tire after dem don defend like say na Champions League final. We change tactics, na so we knack dem one goal. Correct win, correct performance.”

Osimhen injury wahala

But as we dey celebrate, gbege land. Naija star boy Victor Osimhen chop ankle injury first half. E no fit continue, na Cyriel Dessers from Panathinaikos come replace am.

  Super Eagles Lose Em Wings Against South Africa as World Cup 2026 Ticket Don Cut

Victor Osimhen injury update

Chelle no wan over-talk but drop small update:

Victor ankle dey pain. We go wait till tomorrow morning make we sabi how e be. I go still reason with physios make we know if e fit show against South Africa.”

Tactics matter – Fans dey drag, coach dey defend

Eagles first half na wah. Rwanda park bus like dem be Bolt drivers. But Chelle no gree hear word as fans dey blast say e start 4-4-2 diamond.

  Super Eagles Midfielder Frank Onyeka Talk Say Dem Dey Inside “Wahala” Before Qualifiers

That one na my style. We get plenty chances, but football no dey balance. Sometimes you create ten, score one. Na win matter pass. If we knack South Africa 1-0 too, I go dey happy.”

Eric Chelle celebrates Super Eagles Rwanda Victory

So, even though ball no sweet like jollof, Chelle still dey stand gidigba for him tactics. Nigerians bin expect fireworks, but na slim win dem carry go house.

  Tolu Arokodare Carry Super Eagles Fly Pass Rwanda for 2026 World Cup Qualifier

For beer parlour everywhere, gist dey: “Na win be win o, but Eagles suppose dey ball like old school days wey dem go hammer team 4-0 sharp sharp.”

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Be the first to comment on "Super Eagles coach Eric Chelle dey jubilate for Rwanda win: “Na we dominate dat match”"

Leave a Reply