Ashleigh Plumptre Knock Better Header Wey Carry Super Falcons Enter WAFCON 2026

Nigeria vs Benin WAFCON qualifier action in Abeokuta

Na so e be o! The Super Falcons don finally knack their WAFCON ticket after dem hold the Amazons of Benin to 1–1 draw for MKO Abiola Stadium, Abeokuta, on Tuesday evening.

Super Falcons celebrate WAFCON qualifier success

Even though e no be smooth cruise like first leg, our babes still show say dem be oga for this continent. Aggregate finish 3–1. Job done. Morocco 2026, here we come, na weytin hitvibz yan be dat

Super Falcons Wey Get Ginger From the Start

See as dem start fire from early! Ashleigh Plumptre—yes, our fine defender wey sabi tackle like bouncer—finally score her first goal for Naija after 25 matches. Na serious “about time” matter.

The babe jump like say she dey chase suya for charcoal, nod Okoronkwo’s fine fine corner enter net for 12th minute. Abeokuta scatter! Fans shout “Up Super Falcons!” till voice crack.

  Vivian Ikechukwu burst net but e no still reach as Santos Laguna season end with premium beating

Super Falcons 1-1 Benin

No be lie, after that 2–0 away win for Lomé, our girls enter this match with serious confidence like person wey don chop pounded yam and goat meat soup.

Chinwendu Ihezuo and Okoronkwo wey score that time sef, still dey waka around like say dem fit score again from anywhere.

Falcons just dey control midfield like dem dey play “monkey post.” Pass here, dribble there. Benin defence no even rest. Nnadozie for post dey chill like she dey watch Netflix — nothing reach her side for first half.

Benin Try Flex Muscle, But Falcons Still Get Sense

Second half come, Benin say dem no go gree. The Amazons finally catch small chance for 61st minute. One kind small mistake for our backline and gbam! Ball don enter. 1–1. Abeokuta quiet small.

  Edna Imade matter don hot pass Cameroon Pepper — Naija and Spain don dey drag her neck

Ashleigh Plumptre scores header for Super Falcons

You fit see tension for people face — beer vendors sef pause mid-pour. But our Falcons no panic. Dem just calm down, rearrange shape, hold ball like boss ladies.

Benin try press again, but dem jam solid wall. Time dey go, referee blow final whistle, and na Naija wey dey celebrate again. Another WAFCON, another cruise for our queens.

Naija Queens Eye World Cup Next

No be only qualification matter o. This WAFCON ticket don ginger the Super Falcons for the next big thing — the 2027 FIFA Women’s World Cup wey go happen for Brazil.

Ashleigh Plumptre Header Sends Super Falcons Through to 2026 WAFCON

If dem continue with this swagger, e go be wahala for anybody wey cross their path. Falcons don show say even if small slip happen, dem still sabi finish business.

  Super Eagles Abroad: Maduka Okoye Stand Gidigba, Orban and Imade Just Dey Run Things

So make una raise glass — palm wine, stout, or zobo — anyhow you like am. Our girls don qualify. Naija no dey carry last!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

About the Author

Hitvibz Media
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "Ashleigh Plumptre Knock Better Header Wey Carry Super Falcons Enter WAFCON 2026"

Leave a Reply