NPFL Matchday 13: Ikorodu City dey top, Insurance give fans joy, Rivers still dey run unbeaten

NPFL Week 13 action as Ikorodu City defeat Plateau United

Chai! This Nigeria Premier Football League (NPFL) matchday 13 wahala no be small thing last weekend. Ikorodu City don dey run the table for the first time ever — people never believe am for their eyes.

Ikorodu City celebrate historic NPFL top spot after matchday 13 win

Meanwhile, Bendel Insurance drama, Rivers United flair, and Bayelsa United fight no gree the league rest easy, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Make we break down weytin Sup for NPFL Matchday 13

Ikorodu City Don do History at Onikan

Omo, Onikan Stadium turn theatre last Saturday! From the day wey dem first waka enter NPFL pitch (Sept 8, 2024) to November 16, 2025, Ikorodu City don waka come top like them be real Lagos giants.

First half? Na wahala, nothing dey happen. But after break, gbege start! Joseph Arumala knack the first goal two minutes into second half — crowd dey shout like them just win lottery.

Ikorodu City 2–1 win in NPFL Week 13 vs Plateau United

Alade Balogun no gree slack, him double am six minutes later.

Plateau United try to waka back with Wisdom Ndon goal for 72nd minute, but Ikorodu boys remain calm, lock them gate.

Omo, this win mean say Ikorodu City don run eight games without L, four home wins in a row, and dem don siddon for top on 24 points.

  NPFL Give Enyimba and Rangers Big Fines and Punishment for Matchday 35 Wahala

Naija football never see second season club do am like this before. Dem no just win, dem don announce demself.

Bendel Insurance End Their Wahala in Style

Benin naija stadium no calm last Sunday. Bendel Insurance finally shake off four-game curse with a 3–2 comeback wey go make beer parlour boys shout “Naija football no dey carry last o!”

Kayode Oke Solomon knack early goal, but Kano Pillars try shake things with Rabiu Ali penalty and Chiedozie Okorie quick strike.

Omo, Insurance no gree give up. Emmanuel Dung level am for 74th minute, and Akpan Emmanuel use stoppage time hammer the winner. First win under Kennedy Boboye don land!

Pillars? Dem don dey six matches without win under Babaganaru. Ehn, na proper wahala be that.

Enyimba Fall Again for Aba

People’s Elephant no fit hold house. Wikki Tourists knock dem 1–0 inside 33rd minute.

Enyimba lost 1-0 to Wikki Tourist

Chai! Home crowd shock die. Enyimba season dey do zig-zag — e dey painful to see.

Rivers United Fight Wella for South-South Derby

Warri Wolves show small skill first with Adebambo Ademola goal for 25th minute. But Rivers United no dey carry last.

Emmanuel Nnaji waka through two defenders like say dem dey for playground, level am. Samuel Obi carry breeze finish for 58th minute to give Rivers full control.

  Who Fit Stop Dem? Wikki Tourists, Barau FC, Kun khalifat & Warri Wolves Don Land for NPFL

Finidi George side don run five games without L now, back-to-back wins dey push dem near top.

Niger Tornadoes Crush Katsina United

For Minna, Tornadoes no play play. Ismail Sarki knack early goal inside 11 minutes, Abdulrasheed Dabai seal am for 66th. 2–0 comfortable win, dem dey still dey chase top-five spot.

Bayelsa United Outfight Abia Warriors

Bayelsa United show say dem no dey carry last. Chinedu Sunday open scoring early, Sunday Megwo try draw back for Warriors just before half, but Chinedu Emmanuel hammer lead again after hour mark. Strong disciplined finish give dem 2–1 win.

Nasarawa United Slip from Top After Draw

Nasarawa United enter match week 13 dey hold top spot, but dem waka come second after 1–1 draw with Kun Khalifat. Anas Yusuf score early, Stanley Otu equal 25 minutes from end. Table balance change small.

El-Kanemi Warriors End Kwara United’s Magic Run

Kwara United seven-game unbeaten run? Done finish! Muktar Ismail open scoreboard 37th minute, Daddy AbdulRahman add second later. Kwara dey try hit woodwork, miss plenty chances. Dem fall to 12th.

The Remaining Fixtures

Barau FC vs Rangers International (Monday, no crowd)

Shooting Stars vs Remo Stars postponed

NPFL Matchday 13 Results at a Glance

– Bendel Insurance 3–2 Kano Pillars
– Niger Tornadoes 2–0 Katsina United
– Enyimba 0–1 Wikki Tourists
– Bayelsa United 2–1 Abia Warriors
– Ikorodu City 2–1 Plateau United
– Rivers United 2–1 Warri Wolves
– Kun Khalifat 1–1 Nasarawa United
– El-Kanemi Warriors 2–0 Kwara United

Standings: See How Top of Table be After NPFL Matchday 13

Standings_ A Close Race for Top Spot After NPFL Matchday 13

Standings: See How Bottom of Table be After NPFL Matchday 13

Standings_ Struggle at the Bottom After NPFL Matchday 13

Wetin Go Next After NPFL Matchday 13?

Ikorodu City go test Kano Pillars for proper top clash.

  CHAN 2024: See di 5 NPFL Clubs Wey Go Produce Di Next Super Eagles Stars

Enyimba vs Wikki Tourist

Nasarawa United host El-Kanemi Warriors for Lafia, first place dey on line.

Rivers United waka go try CAF Champions League glory.

Bayelsa United go face Wikki Tourists after morale booster win.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

About the Author

Hitvibz Media
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "NPFL Matchday 13: Ikorodu City dey top, Insurance give fans joy, Rivers still dey run unbeaten"

Leave a Reply