Rivers United Scatter Black Bulls 3–1, Chop Group Stage Ticket for CAF Champions League

Rivers United

Rivers United show correct spirit for Uyo as dem flog Black Bulls 3–1 for their CAF Champions League second-leg showdown for Godswill Akpabio Stadium, clear road enter group stage of Africa biggest club competition.

Match wey suppose happen Sunday shift go Saturday because Davido wan shutdown the stadium for concert — and as e be, na Rivers United the change favour, as dem land Uyo with new ginger after dem lose first leg 1–0 for Maputo, na weytin hitvibz yan be dat

Rivers United Take Charge for CAF Champions League Wahala

After Remo Stars chop 5–1 disgrace from Mamelodi Sundowns, na Rivers United carry Nigeria hope for pocket enter this fight like Avengers of NPFL.

Finidi George boys start the match like men wey no dey smile at all. Just 15 minutes, one wicked free-kick scatter Black Bulls defence, ball bounce anyhow, and Wasiu Falolu no dey dull — GBOSSA! — he smash the ball inside net. 1–0. Stadium vibrate!

Pressure no gree stop. 42nd minute, wahala again. Penalty for Rivers. Maclyn Biokpo waka go spot, no shake, just send keeper go buy Fanta as ball go the other side. 2–0. Halftime. Uyo dey on vibes.

Zachariah Land Killer Punch as Rivers March Go Group Stage

Second half never even settle, Black Bulls rush commot like people wey forget pot for fire. 47th minute, Moctar Diallo score one sharp goal. Aggregate don balance like PHCN bill — but Rivers boys no panic, no scatter, no lose head.

Garden City giants hold their shape. Hold their swagger. And finally, 76th minute — the moment wey burst champagne — Timothy Zachariah deliver one missile finish. Net shake. Uyo scatter. 3–1 on the night, 3–2 overall. Game over. Lock am. Seal am. Stamp am.

Na Rivers United biggest win this season and e don carry dem enter CAF Champions League group stage where bigger head and stronger gbas-gbos dey wait.

The journey don start proper.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

About the Author

Hitvibz Media
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "Rivers United Scatter Black Bulls 3–1, Chop Group Stage Ticket for CAF Champions League"

Leave a Reply