Naija midfielder Stanley Charles no carry last at all on Wednesday night as him scatter everywhere for Czech Republic Liga 3.
The boy enter field, ginger morale, and still knack last goal wey seal FC Trinec 5-0 away massacre of Slovacko B. For Stadion Na Belince, na pure “men vs boys” show wey happen, na weytin hitvibz yan be dat
Stanley Charles Put Full Stop For Trinec Dominance
The 22-year-old Naija baller wey don already show him scoring hand before (11 goals in 34 matches for Zlinsko) no dey dull for new club.
This season alone, he don rack four goals in just four games. Baba dey hot like December sun.
But e no dey alone. Another Naija blood, Paul Ndubuisi, start for Slovacko B but wahala catch am—injury force am commot after only 13 minutes.
Samson Olayiwola sef show face before coach drag am out give another Naija padi, David Okoromi.
Adam Alabi try hold ground reach 67 minutes before dem sub am too. Naija everywhere, but na Charles name enter headline.
Trinec na wah! Them tear Slovacko B like Ankara cloth. Round 17 of MSFL turn real training ground as goals dey enter steady.
How Goals Take Enter Like Free Beer
First break? 38th minute. Rene Dedic chop life, calmly slot am in. 1-0. From there, na cruise control.
Just before halftime, Tomas Omasta double wahala. Come second half, the same Omasta return again for 52nd minute—2 goals in the bag. Slovacko players come dey look each other like “who send us come?”
Then na fresh pepper enter. Double sub in 56th minute bring Stanley Charles inside. As e land, pace change.
By 72nd, Jakub Bolf add 4th goal. Then the big finish—Stanley Charles put final nail for coffin with sweet 5th goal, five minutes to go. Fans of Slovacko just dey look like man wey bar girl chop im last 1k.
Trinec Drop Heavy Statement With 5-Star Show
This one no be ordinary win. Na statement. Clinical goals. Total control. Attack wey dey sharp like razor blade.
Trinec don use this kind flogging remind everybody say dem still dey top of the table with 17 points—five wins, two draws, no shaking.
Slovacko? Dem go dey lick wound reach weekend. Humbling no be small.
Next stop for Trinec na Brno B. If dem carry this same form, Brno boys go dey reason excuse before match start.





Be the first to comment on "Stanley Charles Burst Net As FC Trinec Wipe Slovacko B 5-0 for Czech Liga 3"