Naija striker Cobnan Moses burst headline on Saturday as e knack two correct goals for FC Rostov head, helep FK Krasnodar win dem 4-2 for house friendly match wey sweet fans belle reach final whistle.

Cobnan Moses dey celebrate brace vs Rostov

Cobnan Moses shine with two goals for FC Rostov head

Di 22-year-old striker wey knack four goals plus one assist for Russian Premier League last season show him self again, na weytin Hitvibz dey report.

Him two goals for Rostov body na wetin helep Krasnodar show say dem senior di Russian rivals for Krasnodar Academy Stadium.

  William Agada knack em first MLS assist, na em magic help Real Salt Lake beat St. Louis

Cobnan Moses brace help win FC Rostov

Di match wey full action start as Victor Sá put ball for net for first minute. Jhon Córdoba come double di lead 24 minutes later, show say Krasnodar attack na fire.

Rostov manage find one goal through Timur Suleymanov before halftime, make di score na 2-1.

But as di match restart, Moses knack him first goal for di day, come bring back Krasnodar two-goal lead, show why him still be big baller wey dem dey watch.

FK Krasnodar and Cobnan Moses for friendly match

Last-minute gbege: Cobnan Moses seal am with second goal

As di match wan finish, Rostov’s Egor Golenkov still give dem hope with goal wey make am 3-2 for 83rd minute.

  Umeh Emmanuel Dey Front as Naija Ballers Scatter Europe with Goals Like Fireworks

But di day na for Moses hand — him still knack another goal for 89th minute, make am two goals against FC Rostov, come wrap di match with sweet 4-2 win.

Now now, Moses and FK Krasnodar go focus for Russian Super Cup Final against CSKA Moscow for July 12th, make dem carry di ginger reach there.

You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 6, 2025 1:53 pm by Hitvibz Media