Super Falcons of Naija don start dia 2025 Women’s African Cup of Nations (WAFCON) wella as dem nack Tunisia 3-0 for Casablanca, Morocco.

Super Falcons celebrate WAFCON 2025 win over Tunisia

Dis Naija babes don send better warning give other African teams after dem beta am 3-0, na wetin Hitvibz dey report be dat.na wetin Hitvibz dey report be dat.

Super Falcons sharperly knack Tunisia

Goals from Asisat Oshoala, Babajide Rinsola and Chinwendu Ihezuo na wetin the Naija babes need take show say dem mean business for dis tournament.

Rinsola Babajide goal seals Super Falcons Tunisia win

From kickoff, the Falcons show say dem still be the team to beat for WAFCON.

E no even reach four minutes, Naija don score. Babajide Rinsola send correct cross, Oshoala jump reach sky, nod am enter net.

  Gift Monday don hammer double digits as she ginger Washington Spirit enter NWSL final

With dat early goal, Naija women control the game wella — dem dey pass ball sharp sharp, hold midfield and push der opponent back enter dia own box.

Rinsola and Ihezuo come kuku finish work

Even though some passes for Tunisia box no connect, dem still find way break through. Just as first half wan end, Rinsola knack another goal make am 2-0.

Asisat Oshoala scores opening goal WAFCON 2025

VAR check come show say Oshoala no foul anybody before the goal, so referee gree the goal stand.

  Super Falcons star Esther Okoronkwo don collect Player of the Match afta dem knack Tunisia

Rinsola still do Diogo Jota style celebration, to hail the Liverpool baller wey kpai on Thursday.

With just six minutes remain for game to finish, Chinwendu Ihezuo come seal am — she sharply push ball enter bottom corner, make am 3-0 for Naija.

  Super-sub Joy Omewa tear net again — 21 goals as Fortuna knack better comeback vs Koge

Na so Super Falcons take start dia WAFCON journey with better ginger.

You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 6, 2025 9:23 pm by Hitvibz Media