Super Eagles Lose Em Wings Against South Africa as World Cup 2026 Ticket Don Cut

South Africa vs Nigeria in world cup qualifier

The Super Eagles don kiss World Cup goodbye after dem knack 1-1 draw with South Africa for Toyota Stadium inside Bloemfontein.

Super Eagles battle South Africa in World Cup qualifier

Even though Naija still dey carry that unbeaten ginger against Bafana Bafana for qualifiers, the draw mean wahala – six points dey clear like NEPA light, and only two games remain. Otilo, na weytin hitvibz yan be dat

Early gbege for Super Eagles: Aina wound, Ekong wahala

Naija night start with bad luck. Just eight minutes wey game never even hot, Ola Aina don limp comot. Fans never even sit well, wahala don land.

South Africa vs Nigeria in world cup qualifiers

Before person fit sip beer finish, another kasala burst – William Troost-Ekong mistakenly jam ball enter him own net. Bafana carry 1-0 lead dey dance shaku-shaku.

To add pepper, that goal mean Naija never sabi keep clean sheet against South Africa for their last eight meetings. Na which kind juju be this?

  Super Eagles coach Eric Chelle dey jubilate for Rwanda win: “Na we dominate dat match”

Bassey show body, rescue one point

But Super Eagles no gree die. Bright Osayi-Samuel wey just enter show him skill, deliver sweet cross like party jollof. Calvin Bassey rise like say dem tie rocket for him head, nod am inside net – 1-1.

Calvin Bassey celebrating his goal vs South Africa

The boys push hard, throw body, but that winning goal no gree show face. Na so e end.

  Super Eagles Midfielder Frank Onyeka Talk Say Dem Dey Inside “Wahala” Before Qualifiers

Wetin e mean for Naija ball

Yes, we still hold record – six games unbeaten against Bafana (three win, three draw). But make we no deceive ourselves, this 1-1 no save Naija World Cup waka.

Back-to-back we don miss the world biggest football stage. E pain. For country wey get talent scatter for Europe, na shame we dey collect steady.

South Africa dey top group with 17 points, Naija dey second with 11. Six points gap, two games left – my brother, na mathematics wey no get solution.

Calvin Bassey scores header for Super Eagles vs South Africa

Next stop: Lesotho on October 6. After that, Benin on October 13. But make we talk true, the World Cup don waka go without us. Na just pride dey remain.

  Ex-Super Eagles Baller Yan Say Rivers United “Park Bus” Against El-Kanemi Warriors
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Be the first to comment on "Super Eagles Lose Em Wings Against South Africa as World Cup 2026 Ticket Don Cut"

Leave a Reply