Troost-Ekong See Premium Shege as Cristiano Ronaldo Drop Goal No. 928 for Al-Nassr Sweet Show

Troost-Ekong and Cristiano Ronaldo

Super Eagles captain William Troost-Ekong no go forget dis match quick, as Cristiano Ronaldo run show again, knack him 928th career goal, help Al-Nassr flog Al Kholood 3-1.

Troost-Ekong

Na serious wahala for Al Awwal Park as Al Kholood no fit stop CR7 for dis Saudi Pro League round 25 game wey happen Friday night, Hitvibz reports.

Even though dem try, Al Kholood no fit hold Ronaldo, wey no waste time before e begin do him usual magic.

Troost-Ekong See Shege as Cristiano Ronaldo Dey Ball

E no even reach five minutes before Cristiano Ronaldo show himself. As ball drop for box, baba just fire am enter net like say na training.

Dis na him 19th goal for di season, wey help am lead players like Abderrazak Hamdallah, Karim Benzema, and Ivan Toney for goal chart.

  Super Eagles coach Eric Chelle dey jubilate for Rwanda win: “Na we dominate dat match”

Troost-Ekong See Premium Shege as Cristiano Ronaldo Drop Goal No. 928 for Al-Nassr Sweet Show

Troost-Ekong play full match, but e no really see ball like dat—e touch ball only 35 times, di least for any player wey complete di match.

Even though e try for defense, make seven recoveries, two clearances, and 87% correct passes, e team still chop beating.

Ronaldo No Wan Stop Until E Reach 1000 Goals

Even as em don reach 40 years, the former Man United bobo no wan hear say e don old. From Sporting go Manchester United, Real Madrid, Juventus, and now Al-Nassr, baba just dey break record anyhow.

  Super Eagles Lose Em Wings Against South Africa as World Cup 2026 Ticket Don Cut

Cristiano Ronaldo

E don already set him mind to knack 1000 career goals, and di way e dey go, e fit no even take long.

Meanwhile, Troost-Ekong go shift focus now, as e go carry Super Eagles enter camp ahead of di World Cup qualifiers wey dem go play against Rwanda and Zimbabwe.

You like dis post?
We go happy to hear from you. Drop your comment for di box below!

Leave a Reply