From NLO to NPFL? E-World United goalie Najeeb Saad don yan im big dream after promotion

From NLO to NPFL? E-World United goalie Najeeb Saad don yan im big dream after promotion

E-World United FC goalkeeper Najeeb Saad don set im eye well-well for Nigeria Premier Football League (NPFL), and di kain story wey e get fit ginger any young baller wey dey hustle ball for street.

Najeeb Saad of E-World United FC don dey dream of NPFL

After e help E-World United promote from Nationwide League One (NLO) go Nigeria National League (NNL), Saad dey dream to play for some big big clubs for Naija, na weytin hitvibz dey yan be dat.

For one exclusive tori wey e yan give Footballrover, di goalkeeper talk how im football waka don be so far and wetin dey push am to aim higher.

Najeeb Saad: “Na Better Journey” to NPFL Dream

Saad wey come from Taraba State join E-World United FC this same season but e no waste time show say e sabi work.

When dem ask am about di journey so far, e just yan: “Na better journey.”

Najeeb Saad dey eye NPFL after big win

Di journey climb another level when E-World United knack Ahudiyannem FC 2-1 for their final NLO playoffs match.

Before dem land Port Harcourt, Saad and im guys don already set their mind: “First position,” na wetin e yan sharp sharp.

And as dem carry first, e no fit hide im joy: “I dey happy well well now.”

NPFL dey front: Confidence, Teamwork and Big Dream

Anybody wey watch Saad for post go sabi say di guy dey sure of himself. When dem ask am where di confidence dey come from, e salute im guys: “Na my teammates, I believe for dem.”

Even when e concede one yeye goal wey come from slip for match against FC One Rocket, e no too send: “I slip, di pitch dey slippery.”

Now wey di Southern Zone don clear, di next level na NLO Super Eight.

Im target? “To win di Super Eight na him sure pass.” E trust im guys and dem too dey trust am back: “I believe my teammates, na why I dey bold for post.”

After di big win, di club owner Engr. Etim Okon yan say one million naira cash dey come.

Saad sure die say di money go show: “Yes na! E go come; I dey sure wella. Even if na ten million naira, baba go deliver.”

Bigger Target: NPFL Clubs dey Saad Mind

But Saad eye dey front, na NPFL e wan enter. When dem ask am if e dey dream Naija top league, e no waste mouth: “Yes na! Na my dream be dat: to play for Remo Stars, Kano Pillars, Rangers International or even Rivers United.”

Goalkeeper Najeeb Saad dey celebrate NLO promotion

And which one e go like enter first? “Remo Stars, I like di team, dem dey play like family. I love di team.”

One special thing wey dey make am stand out na di kain long throw wey e get — e dey turn defence to attack for blink of eye: “Na my asset be dat. Na only breeze dey stop di throw, if breeze no dey, e go reach opponent box sharp sharp.”

As Najeeb Saad dey target NPFL, di waka from NLO show say believe, teamwork and big dream fit open gate to Naija top league

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Be the first to comment on "From NLO to NPFL? E-World United goalie Najeeb Saad don yan im big dream after promotion"

Leave a Reply