Naija pikin dem dey burst brain for Gothia Cup 2025 as Sporting Lagos FA and Sporting Supreme still dey unbeaten, dem don top dia groups and waka enter knockout round sharp sharp.

Sporting Lagos FA Shut Down Group Stage With Style

All six Naija teams show correct levels for Matchday Three, finish strong and show say dem no come Sweden play at all, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Sporting Lagos FA Shut Down Group Stage With Style

Sporting Lagos FA finish group stage on a high, beat Mjällby AIF 3-1 for Heden 4 – Puma.

Ebube Emmanuel, Oluwaseun Akanji, and Naziru Ishaq nack dem the goals wey seal the three points for Lagos boys.

Dem finish on top of dia group with seven points – two wins, one draw, five goals scored, only two enter their net.

  Gothia Cup 2025: Nigeria Eagles Carry B16 Trophy After Dem Win All Dem Matches

Ebube Emmanuel and Oluwaseun Akanji dey share top scorer spot for the team with two goals each.

Next stop na knockout stage, where dem go jam IFK Norrköping.

Sporting Supreme Na Real Wahala – Three Wins, Zero Wahala

Sporting Supreme no even slow down, beat IFK Skövde FK 3-0 for Slättadamm 1, run perfect group stage with three wins from three.

Nigerian Eagles Fly High, Enter Knockout With Fire

Dago Grah Tehouan open the goals, then Stanley Ogbonna Chizurum carry two goals join body – the guy don score four for the tournament.

Dem top dia group with nine points, 15 goals scored, and dem never even chop any goal yet.

Next challenge na Åtvidabergs FF for knockout round.

Beyond Limits FA No Get Chill – Another Win Again

Beyond Limits FA just dey clear road. Dem beat GIF Sundsvall 2-0 as Saka Yusuf Adekunle nack two goals for first half.

Mailantarki Care Sport FC Manage Enter Knockout With Clean Sheet

The guy don carry three goals total. Dem finish on top dia group with nine points, 10 goals scored, zero enter their own net.

  Beyond Limits FA Wash BK Häcken 9-0 for Gothia Cup Opener – Dem No Get Mercy!

As usual, dem dey eye that Gothia Cup title again.

Derby Football Club Hustle Enter Second Place

Derby FC show say dem serious, beat Östers IF 1-0. Na Umole Famous score quick one for 5th minute.

Derby Football Club Hustle Enter Second Place

Dem finish second behind Right to Dream with six points, and now dem go face GIF Sundsvall for knockout.

Selnan Praise Bali still dey lead their goals with two goals.

Mailantarki Care Sport FC Manage Enter Knockout With Clean Sheet

Mailantarki hold Holmalunds IF 0-0, and that one still reach for dem to qualify second from group.

Beyond Limits FA No Get Chill – Another Win Again

Dem no lose any match – one win, two draws – and dem no let any goal enter, still get six goals scored.

Ejiogu Samuel Uchenna and Chukwusa Godstime Matthew both get two goals each as dem prepare to jam Lindsdals IF next.

Nigerian Eagles Fly High, Enter Knockout With Fire

Nigerian Eagles use correct style finish group stage – dem scatter Österåker United FK 1 4-0.

  Gothia Cup: Beyond Limits Shock Right to Dream, Sporting Supreme Fire Enter Final

Mubarak Adisa, Shamsu Mustapha, and Ezekiel Oshofowokan all score join body.

Sporting Supreme Na Real Wahala – Three Wins, Zero Wahala

Dem finish with nine points, 13 goals scored, and na one of the hottest attacks for Gothia Cup now.
Fawaz Salami still dey run show with six goals so far.

From Sporting Lagos FA’s rugged performance to Sporting Supreme’s total dominance, Naija teams dey shine wella for Gothia Cup 2025.

Knockout stage don set, and the hustle for the trophy don hot – Naija dey inside the matter gbagam!

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 16, 2025 10:31 pm by Hitvibz Media