Beyond Limits FA no even use eye look BK Häcken as dem land Sweden for Gothia Cup. Dem just tear dem nyash 9-0 for Group 5 first match for di 49th edition of di tournament.
Di Naija small boys show say dem no dey play from first whistle — na so dem begin craze ball, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Imrana Musa Na Di Starter for Beyond Limits FA
Di match never reach anywhere, Imrana Musa don show say wahala dey. Na him knack di first goal for just five minutes, make BK Häcken shock.
From there, di match don bend go Naija side.
By 11th minute, Oladimeji Muiz carry add another one, show everybody say Beyond Limits come Sweden come mean business.
BK Häcken no even fit catch breeze as goals dey fall like rain.
BK Häcken Chop Better Beating for Gothia Cup Group 5
20 minutes never complete, Merveille Akinocho and Saka Yusuf don add two goals back-to-back. Score don jump reach 4-0 sharp sharp.
Before Häcken fit ask wetin dey sup, Akinocho don score him second goal make am 5-0. Wahala for who no get defence.
Di kasala no stop there. Oreoluwa Agbenla sef carry add number six before first half blow end.
The competition na 30 minutes per half, so Beyond Limits waka go break with 6-0 lead. Madness!
Second half just start, Bashir Ghali add number seven just four minutes in. Na so Naija boys continue dey knack goals anyhow. Imrana Musa come knack him second one join make am 8-0.
47th minute, Oluwatade Oladimeji sef no wan dull. Him run enter scoresheet make am last last 9-0. BK Häcken go wan delete dat match from dem memory.
All dis one sweet Beyond Limits well well because last year na heartbreak dem get — Sporting Lagos Academy run dem commot for semi-final.
Na di same Sporting Lagos later carry di Puma Trophy after dem wash FC Tokyo 4-0 for final for Gothenburg, Sweden.
But dis year, Beyond Limits don para say dem go carry am go final — no pity, no limit.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 14, 2025 3:44 pm by Hitvibz Media




Be the first to comment on "Beyond Limits FA Wash BK Häcken 9-0 for Gothia Cup Opener – Dem No Get Mercy!"