Nigeria Eagles don waka go Gothenburg, Sweden go carry di Gothia Cup 2025 B16 trophy after dem flog Maryland Bobcats FC from America 3-0 for final wey dem play for Gamla Ullevi stadium.
Di team from Lagos no lose any match—dem win all 9, score 31 goals, and just chop 6 goals for back. Na clean record be dat, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Dem don finally lift di Gothia Puma Trophy, show say dem dey among di best young ballers for di whole world.
Mustapha, Salami na Dem Light Up Gothia Cup 2025 Final Match
Di final na one-way traffic as Shamsu Mustapha no even waste time—na just 2nd minute, e don tear net.
E come score another one for 13th minute, before Mubarak Adisa put salt for di matter with di third goal for 27th minute.
Game end 3-0 sharp!
Mustapha and Fawaz Salami both score 10 goals for di whole tournament—dem two na joint top scorers for Naija team.
From Group Stage to Gothia Cup 2025 Final – Dem No Show Mercy
Di B16 category for this year Gothia Cup get 193 teams from 28 countries. Dem divide dem into 48 groups.
Nigeria Eagles land for Group 4 and dem clear everybody:
4-2 vs. LSS Academy
5-0 vs. Vellinge IF
4-0 vs. Österåker United FK 1
As dem top di group, dem enter Playoff A and no look back—any team wey show face, dem clear am.
From defense to attack, dem sabi ball wella—no shaking.
Nigeria Eagles Raise Naija Flag High for Gothia Cup 2025
As dem carry this 2025 B16 title, Naija Eagles no just collect trophy, dem still represent Nigeria well for international level.
Dem ball sense, confidence, and team spirit make people dey yarn about dem.
With 31 goals, 6 conceded and one shining trophy, dem don enter Gothia Cup history gbagam!
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 20, 2025 6:51 am by Hitvibz Media





Stay connected