Beyond Limits FA don turn oga for Sweden youth football as dem knack ASEC Mimosas for final with gbege 7-6 penalty win carry Gothia Cup 2025.
Di final wey shele for Gamla Ullevi on Saturday end 1-1 for normal time before the Nigerian boys use correct liver take lift the ogbonge trophy.
Dem No Carry Last: Beyond Limits FA Journey to Glory for Gothia Cup 2025
From the first match, Beyond Limits show say dem no come play. Dem open ground with 9-0 flogging wey dem give BK Häcken—clear warning to everybody say e go red.
For group stage, dem beat NorCal Premier PDP 1-0, then clean GIF Sundsvall 2-0 to top their group like boss.
Quarter-final come be V-Varen Nagasaki, dem hammer dem 3-0, clean and clear.
Semi-final na another gbege with Ghana side Right to Dream. That match reach penalty after both sides hold themselves strong.
Na so Beyond Limits take win 5-3 for penalty shootout—show say pressure no dey shake dem.
Final Wahala: Beyond Limits FA Beat ASEC Mimosas for Penalty Shootout
Final match na hot rematch full of serious tension. ASEC Mimosas score first, na Zongo Ange Emmanuel Emile score for 5th minute.
But Adeboyejo Emmanuel Ayowonuola no gree, e equalise for 20th minute put Beyond Limits back for the game.
No side fit score again for normal time, so dem enter penalty.
ASEC Mimosas miss two out of eight kicks, while Remo Stars feeder team miss just once—na that one give Beyond Limits the winning edge. Ikenne boys no dull!
This win sweet wella because for 2024 dem stop for semi-final after Sporting Lagos beat dem 5-4. This one na perfect comeback.
Naija Don Show: Beyond Limits Put 9ja Football for Top Again
With this cup, Beyond Limits don carry their first Gothia Cup title and restore Nigeria name for top of youth football.
Dem score 28 goals, concede only 10, and win all their matches. No gree for anybody!
Top striker Musa Imran score five goals, while the team show balance: strong defence, sharp attack, and brain wey no shake under pressure.
Dem don write their name for Gothia Puma Trophy history book and this their run go ginger plenty upcoming ballers from Naija and even outside.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 19, 2025 6:15 pm by Hitvibz Media





Stay connected