Naija forward Babatunde Akinsola show him level over de weekend as he give one beta assist to help AVS Futebol SAD collect shocking home win against de new Portuguese Liga 1 champions, FC Porto.

FC Porto suffer defeat as Babatunde Akinsola shines

Akinsola play de full 90 minutes and na him set up him side third goal as AVS wire de visitors 3-1 for inside Estádio Clube Desportivo das Aves, na weytin hitvibz dey yan be dat.

Babatunde Akinsola Help AVS Wire FC Porto

De 23-year-old boy don get assists for back-to-back matches for AVS, and dis one make am four assists for dis season and six goal contributions for 37 games wey he don play.

  “Una no fit do pim” — Victor Osimhen promise more shege for rivals after Galatasaray win 26th league title

Porto wey just carry de Primeira Liga trophy suffer surprise defeat for de hand of AVS wey don already go relegation for deir Sunday round 33 clash.

Even though Porto hold ball well and try to score plenty times for first half, dem no fit get even one shot on target before break as AVS boys stand gidigba for defense.

Babatunde Akinsola celebrates assist against FC Porto

De home team first score for 23rd minute through Brazilian midfielder Roni, after João Henriques men start de game with ginger.

Porto reply small time for second half when Borja Sainz do one correct move for left wing, and Deniz Gul just touch de ball enter net to make de game 1-1 for 53rd minute.

  Naija Baller Daniel Job Don Save Kongsvinger: Tear Net Again to Keep Dia Unbeaten Run Alive

AVS Carry On with Unbeaten Run as Porto Fall Hand Again

But AVS no waste time as dem take de lead again just five minutes later. Roni fire one wicked long-range shot wey pass Cláudio Ramos enter net.

Porto bring in young boy Tiago Silva make he play him first-team debut, but de visitors struggle to control de game again.

AVS finally seal de win for 80th minute when Aderllan Santos score from one set piece wey Akinsola assist.

AVS Futebol SAD players celebrate win over FC Porto

Porto wahala worst pass as match wan finish after dem give Dominic Prpic red card for one rough tackle.

  Terem Moffi: Super Eagles star dey proud well as e waka comot Ligue 1 Nice go Porto

Dis result don make AVS unbeaten run reach five matches, while Porto no fit reach deir former 91-point record for league again.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on May 12, 2026 10:39 am by Hitvibz Media