Kelechi Iheanacho don ready to come back shine as e prepare to return to La Liga football wit Sevilla afta illness sideline am.
Di Naija striker wey don face wahala both for Spain and wen e go England on loan, dey eye beta fresh start under new coach, as e dey try use 2025/26 season take revive im football life, na weytin hitvibz dey yan be dat.
Kelechi Iheanacho Wahala for Sevilla and Di Loan Wey No Make Sense
Wen Iheanacho join Sevilla last summer as free agent, e bin dey hopeful say La Liga go favour am.
But di debut season no go as e plan am. Di Super Eagles baller manage play only 9 matches and e no score or assist any goal.
By January, Sevilla send am go Championship club Middlesbrough on loan. But still, e no work out.
Na just one goal and two assists e get inside 15 league games. Boro sef no reach playoffs.
Fans begin dey wonder whether Iheanacho still get am, as e performance fall hand well-well.
Sevilla Comeback Fit Be Iheanacho Chance to Blow Again
Now wey e don land back for Spain for pre-season, dem spot Iheanacho dey train solo as e dey recover from indigestion.
Di 28-year-old dey expected to join full squad training later this week – sign say e body dey come back to normal.
With pre-season friendly against Sunderland dey come soon, Iheanacho get big chance to impress new Sevilla coach Matías Almeyda and maybe enter first team again.
Even though we no sabi how e future go be, if e use pre-season perform well, e fit just turn everything around.
Dis return fit be di redemption story wey Iheanacho don dey wait for, as e still wan prove say e still get wetin e take play for top level.
You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!
Last Updated on July 17, 2025 12:39 pm by Hitvibz Media




Be the first to comment on "Kelechi Iheanacho don ready to ball again for Sevilla, dey hope for fresh start after plenty wahala"