E-World FC don run am! Di Calabar boys don finally promote enter di NNL afta dem come back beat Ahudiyannem FC for di last NLO playoff match.

E-World FC Don Promote Enter NNL After Dem Come Back beat Ahudiyannem

Fans wey gather for Sharks Stadium on Tuesday afternoon see how E-World turn di game upside down take secure dia slot for Nigeria National League, na weytin hitvibz dey yan be dat.

E-World Turn Di Game For NNL Ticket

Di team wey dey top table enter di match with plenty ginger.

E-World FC dey celebrate their NNL promotion victory

Dem don already show say dem no dey here play when dem knack Campos FC 3-1 for dia first match and still run FC One Rocket 3-1 for di second one.

Di Cross River boys be real ogbonge favourites for di promotion, and dem show di reason.

  Gombe United Don Collect New Bus—But E Fit Carry Dem Come Back to NPFL?

Ahudiyannem FC wey come from Abia State enter di game sef with small hope and pride. Dem never win any match, dem draw 1-1 with FC One Rocket and chop 2-0 for Campos FC hand.

Di NLO Promotion Playoff — Southern Zone start as both teams dey hungry to score.

Na Ahudiyannem FC first tear net as Ezeibekwe Kingsley score for 29th minute.

E-World FC beat Ahudiyannem FC 2-1, wey help them secure comeback win

But E-World no gree at all say dem go miss di NNL promotion.

Late Goal Na Im Seal E-World FC Big Comeback

Just six minutes afta, luck waka come E-World side as Kingsley wey first score kon turn to di bad guy — e con mistakenly score own goal give Calabar boys level, 1-1 for first half.

  Victor Sochima Dey Back Akwa United as Fans Dey Scatter Mouth Over Their NNL Wahala

E-World FC don land NNL promotion

Second half na serious wahala and gbas gbos.

Na for 78th minute Okon Etim fire di winning goal wey seal di 2-1 win and clear road for E-World to enter Nigeria National League gidigba.

Out of happiness, di club owner and CEO of E-World Group Limited, Engr. Etim Okon, dash di boys one million naira for dia correct performance.

For di other Southern Zone match, FC One Rocket chop 4-2 for Campos FC hand for Yakubu Gawon Stadium Elekahia.

Other Teams Wey Promote Enter NNL

E-World FC go join seven other teams wey don promote this season:

Northern Teams:

Kano Ambassadors – Kano State
Warinje FC – Bauchi State
City FC – Abuja (FCT)
Mai Kunkele – Niger State

  From NLO to NPFL? E-World United goalie Najeeb Saad don yan im big dream after promotion

Southern Teams:

E-World United FC – Calabar
Stormers SC – Ogun State
Hammola FC – Osun State
Ikorodu City FA – Lagos State

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 15, 2025 4:10 pm by Hitvibz Media