Bayelsa Queens don run beta package as dem don sign Janet Akekoromowei wey be Nigeria Women Football League second highest goal scorer for di 2024/25 season.

Janet Akekoromowei na Bayelsa Queens new striker

Wit dis signing from Nasarawa Amazons, di Prosperity Girls don yan clear say dem wan rule Nigeria again and still conquer Africa, Hitvibz reports.

Janet Akekoromowei go bring goal power for Bayelsa Queens

Akekoromowei, wey go rock di popular No. 9 jersey for di Yenagoa team, sabi score goals well well and she no dey fear defenders at all.

Di Prosperity babes go depend on her as dem dey prepare for CAF Women’s Champions League and di new NWFL Premiership season.

Janet Akekoromowei don sign for Bayelsa Queens

Dis move show say Bayelsa babes no dey play as dem wan lift women football for house and for Africa. Di club dey serious to dey bring top players and dey strong every season.

  Bayelsa Queens coach dey hail Lucky Mary & Akekoromowei, say more signings dey come

“I dey happy to join Bayelsa Queens and I no fit wait to give my best for dis great club,” na wetin Janet yan afta she sign.

European clubs bin dey eye Akekoromowei tey tey

Before the Bayelsa famale team grab di deal, big European clubs like Chelsea, Juventus, Bayern Munich and Stuttgart don dey monitor Akekoromowei.

  Rivers Angels still wan dey fight, even after Bayelsa Queens knack dem for South-South Derby

Di 17-year-old Super Falcons striker show her level just last week as she carry Nasarawa Amazons reach President Federation Cup final wey dem lose to Rivers Angels for penalties.

Bayelsa Queens don unveil Janet Akekoromowei as der No. 9

Make una remember say she still collect MVP for di 2025 NWFL Premiership Super Six. Now wey she don land for Bayelsa, she get another chance to show her magic for bigger stage.

As Janet Akekoromowei don join di team, Bayelsa Queens dey ready gidigba to fight for all di trophies wey dey front.

  Rivers Angels Don Unveil New Ballers, Burst Osklean FA 5–0 to Start NWFL Season with Full Cruise
You Like this post abi?
Oya, we go like hear from you abeg. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 3, 2025 8:26 pm by Hitvibz Media