Naija teams no dull at all for di 49th Gothia Cup wey dey happen for Sweden. Sporting Lagos FA lead di charge as dem knack IFK Göteborg for tight match.

Beyond Limits FA dey celebrate Gothia Cup win

From beta win to tough fight, di first round show say Naija boys no come play at all.

Sporting Lagos FA Show IFK Göteborg Pepper

Sporting Lagos hold IFK Göteborg 2-1 for SKF Arena. Ebube Emmanuel open ground with first goal, before Oluwaseun Akanji add another one join am.

Hugo Olsson manage drag one back for IFK Göteborg but Sporting Lagos hold body collect di three points for pocket.

Derby Football Club Start Rough Small

Derby Football Club no too smile for dia first match for SKF Arena as dem lose 0-1 give Right to Dream.

  Gothia Cup 2025: Beyond Limits Still Dey Fly, Sporting Lagos Don Fall Yakata

Na Bi Voli Bryan Christian Zamble score di only goal for 50th minute wey spoil Derby plan. Dem go wan bounce back for dia next game sure sure.

Nigerian Eagles don dey dominate Gothia Cup game

Mailantarki Care Sport FC Scatter IFK Kumla

Mailantarki Care Sport FC no pity IFK Kumla at all as dem wipe dem 6-0 for Torslandavallen 2. Abdullahi Abdullahi open di floodgate early.

Ejiogu Samuel Uchenna no waste time, he nack two quick goals join, Adagharagba Okiemute Godstime plus Chukwusa Godstime Matthew still join chop di matter.

Beta statement win be dat for Mailantarki Care Sport FC.

Nigerian Eagles Fly High Pass Vellinge IF

Nigerian Eagles show say dem sabi ball as dem hammer Vellinge IF 5-0 for Djupedalsplan 2.

Anas Abdullahi score two, Fawaz Salami knack hat-trick for second half – Eagles just dey fly anyhow for Sweden.

  Beyond Limits FA Wash BK Häcken 9-0 for Gothia Cup Opener – Dem No Get Mercy!

Beyond Limits FA Show No Mercy for BK Häcken

Beyond Limits FA no waste time at all, dem use 9-0 humble BK Häcken for Group 5.

Derby Football Club and.other team wey dey play for Gothia Cup

Imrana Musa, Oladimeji Muiz, Merveille Akinocho, Saka Yusuf, Oreoluwa Agbenla, Bashir Ghali, plus Oluwatade Oladimeji all follow score.

After wahala last year, Beyond Limits FA look ready to show say na dem get am this time.

Sporting Supreme Tear FC Arlanda

Sporting Supreme sef no carry last, dem wash FC Arlanda 5-0 for Fjärdingsplan.

Kenneth Anthony, Peter Timothy, Stanley Ogbonna Chizurum, Ebrima Manneh, and Sunday Moses Onah all collect goal for di smooth Gothia Cup start.

  Chibuike Obi Show Em Class for Gothia Cup 2025, Dey Eye Big Show for Denmark

Naija clubs like Beyond Limits FA, Derby Football Club, Mailantarki Care Sport FC, Nigerian Eagles, Sporting Lagos, plus Sporting Supreme dey show muscle for Gothia Cup.

With dis kind performance, fans for house fit dey dream big well well.

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Last Updated on July 15, 2025 7:18 am by Hitvibz Media