E be like say serious better dey come for Naija Women Football League (NWFL) as dem don plan repackage the whole thing before the 2025/26 season go start.
For Port Harcourt, during the 2025 NWFL Annual General Assembly, the big oga for NFF, Alhaji Ibrahim Musa Gusau (wey send Aisha Falode come represent am), yarn say time don reach to rebuild the league from scratch, na weytin hitvibz dey yan be dat.
In short, the message clear like whistle — women football no fit dey do “manage manage” again. E must move from survival level to real business mode.
NFF talk about Minimum Wage and Insurance — No Free Work Again!
Gusau talk am loud and clear: from now on, every registered NWFL player go get standard minimum wage wey NFF go monitor through their Compliance Unit. No more “we go pay you next week” story.
This one na serious game-changer. E mean say female ballers no go dey play for exposure again — dem go play for money and respect.
Another correct move na the compulsory insurance package wey go cover all players for the league.
No more situation wey person go tear ligament and go dey depend on GoFundMe. If you injure, system go hold your back.
As Gusau talk am, “Unpaid salary and zero insurance na recipe for wahala. Professional league suppose guarantee players small peace of mind.” And bros no lie — if ballers no dey happy, ball no fit sweet.
NWFL Feeder Teams Don Enter the Chat — Youths Must Show Face!
Another hot gist wey drop for the meeting na say every NWFL club must open U-15 and U-17 feeder teams. No be optional.
Gusau talk say this one go help develop small girls wey get football blood for their body. Na from there future Super Falcons go come out.
The NFF Technical and Development Department go partner with NWFL to make sure say dem get better scouting, coaching, and digital player tracking.
Meaning say, if you sabi ball for your secondary school and you get talent, one scout fit just see you and boom — you don dey under one club’s feeder team. Na proper “from street to stardom” plan be this.
Raising Standards, No More Shakara League
Gusau no stop there. NFF don talk say dem go raise the bar for governance, coaching, and general league operations.
All coaches go need at least CAF B Licence — meaning say no more “oga wey just sabi shout from touchline.” Players must dey under people wey get sense for tactics and training.
Dem also yarn about better facilities, proper match calendar (no more postponement every week), and turning league games to real football events wey go attract sponsors and fans.
As Gusau take talk am, “We no just wan dey play matches. We wan host football events wey fit bring investment.” In short, dem wan turn NWFL to money-spinner, not charity show.
Countdown Don Start — Bayelsa Queens vs Edo Queens Go Open the Floor!
As the meeting close, NWFL board announce say 2025/26 NWFL Premiership go kick off November 26, 2025.
The league go feature 20 teams, divided into two groups. Bayelsa Queens and Nasarawa Amazons don already get seeded spots for Group A and B respectively.
Opening day fixture go hot pass suya — Bayelsa Queens vs Edo Queens! Two heavyweight clubs, same opening day. Na that kain match wey fit scatter betting slip and trend for X (Twitter).
So make everybody ready — from players to fans — because women’s football for Naija don enter new era. No be small thing o, this season go be wahala for defenders!




Be the first to comment on "NFF tell NWFL clubs make dem get feeder teams, introduce minimum pay plus player insurance"