My people, NPFL matchday 2 don knack us another weekend of gbas gbos football, no dull at all. Goals dey, shocking results dey, and small small drama full ground.
Warri Wolves knack Rangers like say dem dey play friendly, Remo Stars run comeback for away, and Bayelsa United still dey form “no shaking” with their perfect start, na weytin hitvibz yan be dat
Na 17 goals wey enter net across 10 matches — five home win, two away win and three draws. Bros, fans chop bellefull football this weekend.
Di Breakdown of Tori for NPFL Matchday 2
Bendel Insurance 1-1 Shooting Stars
Benin City turn early cinema. 3SC shock crowd with Ismail Ayodele wey score for 5th minute, but Alex Oweilayefa no gree, he balance the game seven minutes later. After that? Both teams dey behave like say na pre-season training. Match end draw.
Warri Wolves 2-0 Enugu Rangers
Warri Boys say “we no dey here to count bridge.” Dem bite Rangers proper. Godwin Oham drop bomb just before halftime, then Prince Ebhonhon seal am in 77th minute. Omo, Rangers shock like NEPA wey off light for weekend.
Ikorodu City 0-0 El Kanemi Warriors
This one na “if you no fit score, no chop.” Both teams cancel each other. Ikorodu hold strong like area boys for junction, while El Kanemi waka home dey vex say net no gree open.
Plateau United 1-2 Katsina United
Peace Boys no see peace for Jos. Sadiq Auwal and Uche Collins knack Plateau early 2–0. Albert Hilary try console dem with 70th-minute goal, but equaliser hide like fuel scarcity.
Rivers United 1-0 Kwara United
Ubong Friday wey dey always carry ginger givPride of Rivers the only goal for 22nd minute. After the loss for Matchday 1, Rivers say “we dey back, no fear.”
Kano Pillars 1-1 Wikki Tourists
Wikki no reason respect. Ahmed Abubakar shock Pillars with 12th-minute opener. But Mustapha Umar save Kano boys with equaliser just before halftime. Everybody carry one point waka.
Bayelsa United 2-0 Barau FC
Bayelsa dey play like say dem wan carry league now-now. Magbisa Wisdom score penalty for 59th, Eyong Ofem add another. Barau boys just dey look like JAMB candidate wey fail.
Enyimba 1-0 Niger Tornadoes
The People’s Elephant finally roar. Joseph Abiodun open scoring in the 6th minute, Tornadoes no fit recover. Aba boys don collect first three points of season.
Nasarawa United 1-0 Abia Warriors
Solid Miners finally show face. Leonard Ugochukwu knack goal for 10th minute, dem hold the lead like man hold his last bar of soap for bathroom.
Kun Khalifat 1-2 Remo Stars
This one na drama series. Newly promoted Kun Khalifat shock everybody with 15th-minute penalty from Henry Ezeonye. But Sky Blue Stars vex, Ibrahim Abubakar equalise for 69th, then Samson Olasupo turn the table in 77th. Remo Stars just remind us say na dem be defending champion.
NPFL Matchday 2 Results in One Glance
Bendel Insurance 1-1 Shooting Stars
Warri Wolves 2-0 Rangers
Ikorodu City 0-0 El Kanemi Warriors
Plateau United 1-2 Katsina United
Rivers United 1-0 Kwara United
Kano Pillars 1-1 Wikki Tourists
Bayelsa United 2-0 Barau FC
Enyimba 1-0 Niger Tornadoes
Nasarawa United 1-0 Abia Warriors
Kun Khalifat 1-2 Remo Stars
NPFL Matchday 2 Table Wahala: Top Spot and Bottom Fight
Up for table, Bayelsa dey shine like new motor. Remo Stars dey chase close, Rivers dey beg chance to enter mix.
NPFL Matchday 2 Table Wahala: Bottom Fight
For bottom? Some teams don dey reason calculator already.
Wetin Dey Next?
Matchday 3 dey corner. Bayelsa go wan keep perfect run, Rivers dey find consistency. Remo Stars don show say dem no dey joke, and Warri Wolves dey smell blood after dem finish Rangers.
Na early days, but bros, this title race don already hot like Lagos traffic for Monday morning.
Be the first to comment on "NPFL Matchday 2: Warri Wolves Show Rangers Pepper, Remo No Gree Fall, Bayelsa Dey Hot"