Who Fit Stop Dem? Wikki Tourists, Barau FC, Kun khalifat & Warri Wolves Don Land for NPFL

Wikki Tourists, Barau FC, Kun khalifat FC, Warri Wolves promoted to NPFL

The Nigeria Premier Football League (NPFL) don welcome fresh vibe as Wikki Tourists, Barau FC, Kun khalifat FC and Warri Wolves secure promotion from NNL.

Wikki Tourists celebrate NPFL promotion

Coach Abdul Maikaba boys knack 10-man Yobe Desert Stars FC 4-0 for Super 8 Playoffs. Yakubu Wonderson no waste time as e fire hat-trick for first half.

Hosea Habila come close shop with the final goal.

Yobe Desert Star player Usman Mubarak collect straight red card just three minutes after Wikki score their fourth goal.

Na so dem announce comeback: “Hello NPFL! We don come back,” Wikki Tourists yarn for social media.

Barau FC, Kun khalifat FC & Warri Wolves Join the Party

Barau FC players jubilation NPFL Promotion

Barau FC sef no carry last as dem history sweet die. Dem knack Doma FC 2-0 for DELSU Stadium, Ozoro, to enter NPFL for the first time ever.

Usman Maidubuji open the show after 19 minutes, Shammasu Mohammed come seal am 14 minutes later.

  Brown Ideye Dey Para For Nigerian Fans Wey Dey Hype EPL & La Liga Pass NPFL

Barau FC and Wikki top the Northern Conference Playoffs with five points each.

Barau FC players jubilation NPFL ticket

Hitvibz hear gist say Barau FC na Deputy Senate President, Sen Barau Jibrin own dem. So Kano State go get another NPFL team like dis — Kano Derby don set: Kano Pillars vs Barau FC!

For South, Kun khalifat FC from Imo State beat Osun United 2-1 for final Southern Conference Playoffs.

  NPFL Warn Clubs: If Una No Package Una Team Well, Na Back Seat Una Go Sit

Kun khalifat FC score inside 6 minutes, add another one for 18th minute. Ganiyu Gberefun manage pull one back for Osun but e no reach.

Warri Wolves no slack. Dem beat Crown FC 2-1. Abdulateef Yusuff score for Wolves after 36 minutes, Crown FC level am two minutes later, but Warri Boys seal am with winning goal for 67th minute.

Kun Khalifat FC and Warri Wolves don come join NPFL

Big Things Ahead for Wikki, Barau FC, Kun khalifat FC & Warri Wolves

The Wolves and Kun khalifat FC top their groups with six points each, join Wikki Tourists and Barau FC for the new NPFL season. Next season go hot!

  Bayelsa United Fall Yakata: Remo Stars Burst Dia Bubble for NPFL Waka

Warri Wolves and Kun Khalifat FC don come join NPFL

You dey happy say Wikki, Barau FC, Kun khalifat FC and Warri Wolves don promote?

You like this gist abi?
Oya, we go like hear from you. Help us drop small comment for the box below!

Be the first to comment on "Who Fit Stop Dem? Wikki Tourists, Barau FC, Kun khalifat & Warri Wolves Don Land for NPFL"

Leave a Reply