Callum Hudson-Odoi: ‘We no go stop to push’ for em 100th Premier League game

Callum Hudson-Odoi: 'We no go stop to push' for em 100th Premier League game

Nottingham Forest winger Callum Hudson-Odoi don finally play em 100th Premier League match and na emotional game against him former team Chelsea, even though e end wit defeat for em team.Callum Hudson-Odoi: 'We no go stop to push' for em 100th Premier League game

Hudson-Odoi sha score one fine goal wey give Forest the lead, but Chelsea no gree oh!! They come back late to win dem for City Ground, Hitvibz reports.

The English player joy no last after em help him team gain small advantage, as em effort no reach to stop Chelsea from knacking dem small 3-2 for their ground.

Mykhaylo Mudryk, Raheem Sterling, and Nicolas Jackson na them score for Chelsea, as dem kuku steal the show from the former Blues forward.

After the game, the 23-year-old winger enter social media page go pour em whole intestine out, come talk about how e feel for am to achieve that milestone for that kind match.

Mixed feelings for my 100th Premier League match; we go dey push till the end. I appreciate the support from both sides,” e write.

Hudson-Odoi career don dey shine well well dis days under Nuno Espirito Santo, as em don manage start 11 out of 14 matches and em score important goals to help dem comot from relegation zone before dey meet Chelsea.

Him two goals against Sheffield United for 3-1 win help am shine well for him season, wey e don score eight goals and two assists so far.

Remember say dem be rate the former Chelsea academy player as the future star wey even make dem give am £150,000-a-week contract for 2019.

But, Achilles injury and loss of form come make dem no like am again for Stamford Bridge.

Chelsea come finally sell am go give Forest for just small £5 million last summer.

Anyways, with the defeat, Hudson-Odoi goal against Chelsea bin be emotional moment for am as em clock 100th Premier League match.

E don prove point small against him former club and e dey push for success with Nottingham Forest.

You like this post? Abeg, we go happy well well if you fit drop your comment for the box wey dey down!

About the Author

Hitvibz Media
An educationist, who loves good music and Football. A creative writer, footballer and content editor.

Be the first to comment on "Callum Hudson-Odoi: ‘We no go stop to push’ for em 100th Premier League game"

Leave a Reply